The starting
God be like papa wey dey do im pikin well. 1 Peter 5:6, 7
Na God make us, and na im still dey give us everything wey we need to enjoy life. As papa wey love im pikin well well take dey teach am, na so God take dey teach us how we go take live better life.
God dey show us better things wey dey inside Bible wey we no sabi before. If we sabi am, e go make us happy and make us believe wetin God talk.
If you want make God protect you and help you with your problem, you must do wetin e dey tell you.
Another thing be sey —you go live forever!