LESSON 23
How We Take Dey Write and Translate Our Book for Different Different Language?
Writing Department, U.S.A.
South Korea
Armenia
Burundi
Sri Lanka
Jehovah Witness people want make everybody for this world hear wetin God talk. Na im make us dey make different different book for many language wey don pass 750. (Revelation 14:6) How we take dey do am? We get some people wey dey for different different country wey dey help us write, and people wey dey help us put am for different different language. All of dem na Jehovah Witness people.
Na English dem dey first use write the book. Na Governing Body dey arrange all the work wey Writing Department for our head office dey do. All the people wey dey write our book wey dey our head office and some branch office dey under this Writing Department. Since we get different people wey come from different different country wey dey do this work, e dey help us write about different different matter about different different tribe. This one dey make our book touch people mind as dem dey read am for their language.
Dem go send the English go give people wey go write am for different different language. After dem don check the English well well and see sey e correct, dem go use computer send am go give people wey go translate am for different different language. This people wey dey translate am for different different language dey choose correct word wey talk wetin English talk. When dem translate am finish, dem go check am and read am to see sey e correct well well.—Ecclesiastes 12:10.
Computer dey make the work fast. Na true sey computer no fit do wetin person go do, but e fit make the work fast because of plenty things wey dey inside. Jehovah Witness people get one computer program wey we dey call Multilanguage Electronic Publishing System (MEPS). This program dey help us arrange the work, put the photo and other things for different different language before we print am.
Why we dey do all this kind work even for language wey be sey the people wey dey speak am no plenty? Na because Jehovah want make ‘everybody sabi the correct thing wey Bible dey talk and get life wey no go end.’—1 Timothy 2:3, 4.
How dem take dey write our book?
Why we dey translate our book for different different language?