How You Think Sey Our Tomorrow Go Be?
You think sey this world . .
go dey like this?
go bad pass like this?
go better pass like this?
SEE WETIN BIBLE TALK
‘God . . . go dry all the water wey dey comot for their eye, dem no go die again, dem no go even cry because of sey person die, trouble and pain no go dey again because all this things don pass.’ —Revelation 21:3, 4, New World Translation.
HOW WETIN BIBLE TALK FIT HELP YOU
You go enjoy better work wey go make you happy well well.—Isaiah 65:21-23.
Nobody go dey sick again, even suffer suffer no go dey again. —Isaiah 25:8; 33:24.
You go enjoy better life wey no go end with people wey you love.—Psalm 37:11, 29.
WE FIT BELIEVE SEY WETIN BIBLE TALK NA TRUE?
Yes, make we see two reason wey go make us believe:
God get power to do wetin e talk. Na only Jehovah Bible call ‘Almighty,’ because na im get power pass. (Revelation 15:3) Na im be sey God fit use im power make this our world better. Bible don talk sey, ‘nothing wey God no fit do.’ —Matthew 19:26.
E dey God mind to do all the things wey e talk. For example, Jehovah really want make people wey don die come life again.—Job 14:14, 15.
Bible still talk sey Jesus wey be God Son, make people wey dey sick well. Wetin make am do am? Na because e come from im mind to do am. (Mark 1:40, 41) As im Father like to dey help people, na so Jesus self like to dey help people.—John 14:9.
This one go make us believe sey Jehovah and Jesus go fit give us better tomorrow!—Psalm 72:12-14; 145:16; 2 Peter 3:9.
MAKE YOU THINK ABOUT THIS QUESTION
How God go take make this world better?
Bible answer this question for MATTHEW 6:9, 10 and DANIEL 2:44.