Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • yc lesson 1 pp. 4-5
  • One Secret Wey We Go Like to Know

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • One Secret Wey We Go Like to Know
  • Teach Your Pikin
  • Similar Material
  • Wetin God Get for Mind for This Earth?
    Good News Wey Come From God!
  • How Life First Be for Paradise?
    Listen to God Make You Live Forever
Teach Your Pikin
yc lesson 1 pp. 4-5
As Jesus dey tell people about God Kingdom, angel come put ear down dey hear

LESSON 1

One Secret Wey We Go Like to Know

Person don tell you secret before?—a Bible tell us about one special secret wey be ‘holy secret.’ E dey holy because e come from God. Na secret because people never hear am before. Even angel self want know more about am. You go want know wetin the secret be?—

Wetin you think sey all this angel want know?

E don tey wey God make the first man and woman. The name of the man na Adam and the name of the woman na Eve. God put dem for one fine place for Eden. That fine place na Paradise. If to sey Adam and Eve hear wetin God talk, dem and their pikin dem for make this world fine like that Paradise. And dem for enjoy life wey no go end. But you remember wetin Adam and Eve do?—

Na because Adam and Eve no do wetin God tell dem, na im make us no dey paradise today. But God still talk sey im go make this world fine again, and everybody go dey happy and dem go get life wey no go end. How God go do am? For many many years, people no know how God go do am because na secret.

When Jesus come this world, e teach people plenty plenty things about this secret. E talk sey the secret na about God Kingdom. Jesus tell people sey make dem pray sey make that Kingdom come. Na the Kingdom go make this world be paradise.

You happy as you don know this secret?— Remember sey na only the people wey do wetin Jehovah talk go dey the Paradise. Bible tell us about many many man and woman wey do wetin Jehovah talk. You go like know more about dem?— Make we see who some of dem be and how we fit take be like dem.

READ AM FOR YOUR BIBLE

  • Mark 4:11

  • 1 Peter 1:12

  • Genesis 1:26-28; 2:8, 9; 3:6, 23

  • Matthew 6:9, 10

  • Psalm 37:11, 29

a For all the story for this book, you go see this kind mark (—). This mark dey after some of the question wey dem ask. E go good sey anytime wey you reach there, make you stop make your pikin fit answer.

QUESTION:

  • Why this world never be paradise now?

  • Which special secret Bible talk about?

  • Wetin Jesus teach people about the secret?

  • Wetin you go do if you want dey for that Paradise?

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share