LESSON 3
Rahab Get Strong Faith for Jehovah
One woman wey dem dey call Rahab dey for Jericho. This Jericho dey for Canaan. For there, people no dey serve Jehovah. Do like sey you be Rahab.
When Rahab small, e dey hear many story about how Moses take divide the Red Sea, and how e take carry all Israel people comot for Egypt. Rahab still hear how Jehovah take help Israel people win their enemy for war. But this time, e come hear sey Israel people don gather near Jericho!
Rahab hide the two men because e get strong faith for Jehovah
For one evening time, two men from Israel hide go Jericho because dem want use sense see how the place be. Dem come Rahab house. Rahab tell dem make dem enter come stay. When night come reach, the king for Jericho come know sey two people don hide enter the city and dem dey Rahab house. The king come send people make dem go catch dem. But Rahab don hide dem on top of im house. E come tell the people wey king send sey: ‘Na true sey dem come here o, but e never tey wey dem comot. If una pursue dem, una go catch dem.’ You know why Rahab hide the two men?— Na because sey e get strong faith for Jehovah. E still know sey Jehovah go give Israel people all the land wey dey for Canaan.
Before the two men comot for Rahab house, dem promise am sey when dem come scatter Jericho, im and im family no go die. You know wetin dem tell Rahab make e do?— Dem give Rahab red rope come tell am sey: ‘Hang am for your window. If you hang am, anybody wey dey inside your house no go die.’ Rahab do wetin the two men sey make e do. You know wetin come happen?—
Jehovah save Rahab and im family
After some days, Israel people come march round the city, dem no make noise. Every day dem dey march round the city one time for six days. But when seven days reach, dem march round the city seven times. After that one, dem come shout well well. Jehovah come make the wall wey dey round the city fall. But the house wey red rope dey no fall even sey e dey for the wall! You see am for the picture?— Na only Rahab and im family no die!
Wetin you fit learn from Rahab?— Because Rahab don learn many many things about Jehovah, na im make am get strong faith for Jehovah. You self dey learn many better things about Jehovah. You get strong faith for Jehovah like Rahab?— We know sey you get faith for Jehovah!
READ AM FOR YOUR BIBLE
Joshua 2:1-24; 6:1-5, 14, 15, 20-25
Hebrews 11:31