Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • yc lesson 6 pp. 14-15
  • David No Dey Fear

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • David No Dey Fear
  • Teach Your Pikin
  • Similar Material
  • David Kill Goliath
    Lesson Wey You Fit Learn From Bible
  • Put Mind for Jehovah Sey E Go Give You Strong Mind
    Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book (2016)
Teach Your Pikin
yc lesson 6 pp. 14-15

LESSON 6

David No Dey Fear

Wetin you go do if you dey fear?​— You fit run go meet your mama and your papa make dem help you. But another person dey wey fit help you. Nobody get power pass this person. You know who be this person?— Na Jehovah. Make we talk about one young man for Bible, im name na David. David know sey Jehovah go help am anytime, na that one make am no dey fear.

David mama and papa don teach am about Jehovah since when e dey small. Na this one help David get mind even when things wey fit make person fear happen to am. E know sey Jehovah go help am because na im Friend. E get one time wey David dey carry im sheep waka, before e know, one big lion carry one of im sheep for mouth run! You know wetin David do? E pursue the lion, catch am, come kill am! Another time when one animal wey im name na bear, attack David sheep, David kill am! Who you think sey help David?— Na Jehovah.

Another thing happen wey show sey David get mind well well. Israel people dey fight war with the Philistine people. One person wey dey for the Philistine people side na Goliath. Goliath na giant, e tall well well! Goliath come dey laugh Jehovah and Israel people. Goliath come challenge Israel people make dem come fight with am. For Israel, nobody get mind to fight am. When David hear wetin dey happen, e tell Goliath sey: ‘I go fight you! Jehovah go help me, and I go kill you!’ You no think sey David get mind so?— E get mind no be small! You want know wetin happen again?

David come carry im catapult and five round stone, come go meet this giant. When Goliath see David, e start to dey laugh am sey na young boy. But David tell am sey: ‘You come meet me with sword, but me dey come meet you with Jehovah name!’ David come put stone for im catapult, e come dey run go meet am, e come shoot the catapult. The stone fly go nak Goliath for front of im head! The giant fall for ground, come die. Fear catch the Philistine people, dem come run. How young boy like David go fit kill giant like Goliath?— Jehovah help am, because e get power pass that giant!

David kill Goliath

David no dey fear because e know sey Jehovah go help am

Wetin you fit learn from David story?— You fit learn sey na Jehovah get power pass. Na your Friend e be. Anytime wey you dey fear, just remember sey Jehovah fit help you get strong mind!

READ AM FOR YOUR BIBLE

  • Psalm 56:3, 4

  • 1 Samuel 17:20-54

QUESTION:

  • Wetin David do when the lion and the bear want carry im sheep comot?

  • When Goliath laugh Jehovah, wetin David tell am?

  • How David take kill Goliath?

  • Why e be sey David no fear the lion, the bear, and the giant?

  • Wetin you learn from David story?

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share