Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • yc lesson 13 pp. 28-29
  • Timothy Like to Dey Help People

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Timothy Like to Dey Help People
  • Teach Your Pikin
  • Similar Material
  • Paul and Timothy
    Lesson Wey You Fit Learn From Bible
  • Elders and Ministerial Servants—Make Una Learn From Timothy
    Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2018
Teach Your Pikin
yc lesson 13 pp. 28-29
Timothy dey learn from Eunice, im mama, and Lois, im granmama when e dey small

LESSON 13

Timothy Like to Dey Help People

Timothy na young man wey dey happy to help people. E dey travel go many place to go help people. Because of this one, e enjoy im life well well. You go like to hear about am?—

Na Timothy mama and granmama teach am about Jehovah

Na Lystra Timothy grow. Na from when e dey small, im granmama and mama dey teach am about Jehovah. Im granmama name na Lois, and im mama name na Eunice. When e grow, e ready to teach people about Jehovah.

When Timothy still dey young, Paul ask am whether e go fit travel with am go preach for another place. Timothy sey: ‘Yes!’ E ready to go help other people.

Timothy travel with Paul go Thessalonica wey dey Macedonia. When dem want go there, the place wey dem go trek far well well, before dem come enter boat. When dem reach there, dem help many people learn about Jehovah. But some people come dey vex, dem even want beat dem. Na im make Paul and Timothy comot from there go another place.

Timothy dey travel with apostle Paul for boat

Timothy enjoy better life wey make am happy

After some month, Paul tell Timothy make e go back to Thessalonica make e go see how the brother and sister dem dey. If person no get mind, e no go fit go back to that bad place! But Timothy go there because e get im brother and sister dem for mind. E carry better story come meet Paul when e come back. The better story be sey the brother and sister dem wey dey for Thessalonica dey fine!

Timothy work with Paul for many years. E get one time wey Paul talk sey Timothy na the best person wey e fit send go help other congregation. Timothy love Jehovah and people.

You love people and ready to help dem learn about Jehovah?— If you do like that, you fit get better life wey you go enjoy, like Timothy!

READ AM FOR YOUR BIBLE

  • 2 Timothy 1:5; 3:15

  • Acts 16:1-5; 17:1-10

  • 1 Thessalonians 3:2-7

  • Philippians 2:19-22

QUESTION:

  • Where Timothy grow?

  • Timothy ready to follow Paul travel? Why?

  • Why Timothy go Thessalonica again?

  • Wetin you go do if you want enjoy better life like Timothy?

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share