CHAPTER 28
Why Jesus Disciples No Dey Fast?
MATTHEW 9:14-17 MARK 2:18-22 LUKE 5:33-39
JOHN DISCIPLES ASK JESUS ABOUT FASTING
E no tey after Jesus go the Passover for 30 C.E. before dem come put John for prison. John be want make im disciples dey follow Jesus. But after dem put John for prison, some of dem come dey follow Jesus.
As the Passover for the year 31 C.E dey near, some of John disciples come meet Jesus and ask am sey: “Why we and Pharisee people dey fast, but your disciples no dey fast?” (Matthew 9:14) The Pharisee people dey fast as if to do fasting na something wey person must do. Later, Jesus use this things wey Pharisee people dey do, teach lesson, e sey if dem dey pray dem go sey: “God I thank you sey I no be like other people . . . I dey fast two times a week.” (Luke 18:11.12) John disciples fit dey fast like the Pharisees. Or dem fit dey fast because John dey prison. People wey dey around dey wonder why Jesus disciples no dey fast, maybe to show sey dem no happy for wetin happen to John.
Jesus use one example answer dem, e sey: “The friends of the man wey dey marry no get any reason to cry as far as the man wey dey marry dey with dem, abi dem get any reason? Time dey come when dem go take the man from dem, that time dem go fast.”—Matthew 9:15.
John sey Jesus be like man wey dey marry. (John 3:28, 29) Jesus disciples no need to fast as Jesus still dey with dem. But later when Jesus go die, im disciples no go happy and food no go hungry dem. But things go change when God go resurrect Jesus! That time, dem no go get any reason to fast because person wey dem love die.
Jesus come still talk two other parable, e sey: “Nobody dey use new cloth patch old outer cloth, because the new cloth go tear comot from the cloth and the hole go come big pass before. And people no dey put new wine inside old wineskin. If dem do am, the wineskin go burst, the wine go waste and the wineskin go spoil. But na inside new wineskin people dey put new wine.” (Matthew 9:16, 17) Wetin Jesus mean?
Jesus dey teach John disciples something. E want make dem know sey dem no suppose dey put mind sey im disciples go dey follow the things wey people for Jew religion dey do, like to dey fast. E no come patch the old way the Jews take dey worship or to make am continue. E don reach time to trowey this old way of worship. The kind worship wey Jesus dey encourage dem to follow no be the Jew people own, wey dey teach human being tradition as belief. Jesus no dey try to use new cloth patch old one or put new wine inside old wineskin.