Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • jy chap. 34 p. 82-p. 83 par. 6
  • Jesus Choose Twelve Apostles

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Jesus Choose Twelve Apostles
  • Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
  • Similar Material
  • Jesus Choose 12 Apostles
    Lesson Wey You Fit Learn From Bible
  • Jesus Start to Choose Im Disciples
    Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
jy chap. 34 p. 82-p. 83 par. 6
Jesus go one mountain

CHAPTER 34

Jesus Choose Twelve Apostles

MARK 3:13-19 LUKE 6:12-16

  • THE 12 APOSTLES

E never reach two years wey John the Baptist tell people sey Jesus na the Lamb of God. As Jesus dey preach, people wey get better mind come be im disciples. Andrew, Simon Peter, John, James (John brother), Philip, and Bartholomew (wey be Nathanael) na some of dem. E no tey, many other people come join dey follow Jesus.—John 1:45-47.

Jesus don ready to select im apostles. Dem go receive special training and dem go always dey with Jesus. Before Jesus select dem, e go one mountain, e fit be the one wey dey near the Sea of Galilee, wey no far from Capernaum. E use the whole night pray, dey beg God for better sense and im blessing. The next day, Jesus call im disciples and choose 12 apostles from dem.

Jesus choose the six people wey we write their name for the starting. E still choose Matthew, wey e see for tax office. The remaining five na Judas (wey be Thaddaeus and “James Son”), Simon wey come from Cana, Thomas, James, wey be Alphaeus son and Judas Iscariot.—Matthew 10:2-4; Luke 6:16.

Jesus pray before e choose im twelve apostles

The 12 apostles don follow Jesus travel and e know dem well well. Some of dem na im relative. James and John na brothers, and dem be Jesus cousins. If wetin people dey think sey Alphaeus na Joseph brother, wey be Jesus papa for earth, e mean sey Alphaeus son wey be James go be Jesus cousin.

E no dey hard Jesus to remember the names of im apostles. But you go fit remember dem? One thing wey go help person na to remember sey na two Simon dey, two James, two Judas. Simon (Peter) na Andrew brother, and James (Zebedee son), na John brother. This na one better way to remember eight name of the apostles. The other four apostles na: Tax collector (Matthew), Thomas the one wey come dey doubt, Nathanael, (na im Jesus meet under one tree) and Nathanael friend, Philip.

Eleven of Jesus apostles come from Galilee wey be Jesus hometown. Nathanael come from Cana. Philip, Peter, and Andrew come from Bethsaida but later, Peter and Andrew pack go Capernaum where Matthew dey stay. James and John still dey stay near or inside Capernaum and their work na fish business. E be like sey Judas Iscariot wey sell Jesus, be the only apostle wey come from Judea.

  • Wetin Jesus do after e use the whole night pray?

  • Na which people be Jesus apostles and wetin fit help you remember their name?

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share