Wetin be God Kingdom?
You go talk sey . . .
na something wey dey your mind?
na story wey people dey talk?
na government wey dey heaven?
SEE WETIN BIBLE TALK
God wey dey heaven go start one kingdom wey nothing go fit scatter.’—Daniel 2:44, New World Translation.
Dem don give us one pikin and na for im shoulder the government go sitdown put.’—Isaiah 9:6.
HOW WETIN BIBLE TALK FIT HELP YOU
Good government wey go do better for you.—Isaiah 48:17, 18.
For the paradise wey dey come, we no go dey sick again, and na so-so happy we go dey happy.—Revelation 21:3, 4.
WE FIT BELIEVE SEY WETIN BIBLE TALK NA TRUE?
Yes, make we see two reason wey go make us believe:
Jesus don show wetin God Kingdom go do. Jesus teach the people wey dey follow am sey make dem pray make God Kingdom come and make God do wetin e want for this world. (Matthew 6:9, 10) Wetin Jesus do that time show how God go take answer that prayer.
When Jesus dey this world, e give people wey dey hungry food, e make sick people well and bring people wey die come life again! (Matthew 15:29-38; John 11:38-44) As the person wey go be King for that Kingdom, Jesus show the better things wey people go enjoy.—Revelation 11:15.
All the bad bad things wey dey happen show sey e no go tey wey God Kingdom go come. Jesus talk sey before people for this world go get rest of mind, many many bad things go happen. Ground go dey shake-open (earthquakes), food no go dey again and people go dey fight war.—Matthew 24:3, 7.
All this things don dey happen today. Na im make us believe sey e no go tey before God Kingdom go comot all the wahala for this world.
MAKE YOU THINK ABOUT THIS QUESTION
How you think sey life go be when God go bring im Kingdom come?
Bible answer this question for PSALM 37:29 and ISAIAH 65:21-23.