QUESTION 10
How Bible Fit Help Me?
WETIN YOU FOR DO?
Just think am sey: David dey drive motor for area where e no know before. Everything wey e dey see show sey na where e no know e dey. Na im David come know sey e don miss road. E be like sey e go pass road wey e no suppose pass as e dey drive come.
If you be David, wetin you for do?
WAIT! THINK AM WELL
E get many things wey you fit do, you fit:
Tell person to show you road.
Use map, or wetin dem dey call GPS.
Continue to dey drive, anyhow e be you go reach where you dey go.
Number 3 fit no help you.
Na number 2 better pass number one. Because that map or that GPS fit help you reach where you dey go, if you follow am well.
Na so Bible fit still help you!
This book wey people know everywhere fit help you
when you get problem
know yourself and help you be better person
and show you how to get the kind life wey better pass
ANSWER TO MANY MANY QUESTION WEY DEY WORRY US FOR MIND
As we start to dey talk from small pikin, we dey ask question.
How many star dey up?
Who make dem?
Later we start to dey ask question about life.
Why bad bad things dey happen?
Wetin dey make people die?
What if the answer don dey inside Bible tey tey?
Many people talk sey na so so tori tori wey no be true full Bible, dem talk sey Bible na old school, dem still talk sey e too hard to learn. Na Bible get problem or na wetin people think sey Bible talk be the problem?
For example, people think sey Bible talk sey na God dey control the whole world. But na true? This world don scatter finish o! Na so so suffer suffer full am, people dey sick, people dey die, people poor well well, everywhere na so so wahala. How God wey love people well well fit cause all this bad bad thing?
Wetin Bible talk fit supprise you o!
You go don see sey the advice wey dey inside this book na from Bible. And Jehovah Witness people believe sey Bible fit help us. Because ‘Na God spirit them take write wetin dey inside Bible, you fit use am teach the truth, show people their mistake, correct mistake and show person how e go take live the kind life wey God want.’ (2 Timothy 3:16, 17) E good make you dey read Bible because wetin dey inside still concern us.