LESSON 10
Lot Wife No Obey Jehovah
Lot stay with Abraham wey be im papa brother for Canaan. As time dey go, Abraham and Lot come get many many animal sotey the land no reach dem again. Abraham come tell Lot sey: ‘Abeg choose where you go like go, and I go go the other side.’ This one show sey Abraham no dey think about only imself.
Lot see one fine land wey near Sodom. The land get better grass and plenty water. So e choose that land and carry im family go there. Dem come dey stay there.
The people wey dey stay Sodom and the land wey near am wey be Gomorrah bad well well. Even self, dem dey do bad things sotey Jehovah come sey e go destroy dem. But God want save Lot and im family, so e send two angel go warn dem sey: ‘Make una comot for this city quick quick, Jehovah want destroy am.’
Lot no comot as dem tell am. E dey draw leg for back. So the angel hold Lot, im wife and im two pikin wey be girl for hand and rush dem comot for the city. E tell dem sey: ‘Make una run for una life, make anybody no look back, if anybody look back, e go die!’
When dem reach the place where dem dey call Zoar, Jehovah use fire and sulphur wey fall like rain take destroy the two city finish. As dem dey go, Lot wife look back, e come turn to salt! But Lot and im two pikin no turn to salt because dem obey Jehovah. E pain dem well well sey Lot wife look back. But dem happy sey dem do wetin God talk.
‘Remember Lot wife.’—Luke 17:32