Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • lfb lesson 30 p. 76
  • Rahab Hide People Wey Come Look the Land

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Rahab Hide People Wey Come Look the Land
  • Lesson Wey You Fit Learn From Bible
  • Similar Material
  • Rahab Get Strong Faith for Jehovah
    Teach Your Pikin
Lesson Wey You Fit Learn From Bible
lfb lesson 30 p. 76
Rahab protect the people wey come look the land when e tell the soldier sey dem go another side

LESSON 30

Rahab Hide People Wey Come Look the Land

When Israel people wey go look Jericho reach there, dem stay one woman house. The woman name na Rahab. When the king for Jericho know sey dem come look how the land be, e send soldier go Rahab house. Rahab hide the two people wey come look the land for top of im roof, e come tell the soldier sey dem go another side. E tell the people wey come look the land sey: ‘I go help una because I know sey Jehovah dey una side and because una go win this land. Abeg make una promise me sey una go save me and my family.’

Dem tell Rahab sey: ‘We dey promise you sey nobody for inside your house go die.’ Dem still tell am sey: ‘Tie red rope for your window and nothing go happen to you and your family.’

Rahab house wey red rope dey the window, no scatter but Jericho fence scatter

Rahab come give dem rope wey dem go use come down from im window. Dem come run go the mountain, go hide for three days before dem go meet Joshua. As Israel people cross river Jordan finish, dem arrange how dem go take collect the land. The first land wey dem collect na Jericho. Jehovah sey make dem march round Jericho for six days and na once dem go march round everyday. But for the day wey make am seven, dem go march seven times. As dem dey march, all the priest dey blow trumpet and soldier dey shout as dem fit shout reach. Jericho fence come dey scatter. But Rahab house wey dey the fence no scatter. Rahab and im family no die because Rahab put mind for Jehovah.

‘Na so e still be, dem no sey Rahab na righteous person because of wetin e do when e let stranger enter im house and show dem another place wey dem go pass?’​—James 2:25

Question: Wetin make Rahab help the two people wey come look how Jericho be? Wetin Israel people do to collect the land? Wetin happen to Rahab and im family?

Joshua 2:1-24; 6:1-27; Hebrews 11:30, 31; James 2:24-26

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share