Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • lfb lesson 42 p. 102-p. 103 par. 3
  • Jonathan–Better Friend Wey Get Mind

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Jonathan–Better Friend Wey Get Mind
  • Lesson Wey You Fit Learn From Bible
Lesson Wey You Fit Learn From Bible
lfb lesson 42 p. 102-p. 103 par. 3
Jonathan and the person wey dey hold the things wey e take dey fight

LESSON 42

Jonathan–Better Friend Wey Get Mind

King Saul senior pikin Jonathan, na soldier wey get mind. David even sey Jonathan fast pass eagle and strong pass lion. One day, Jonathan see some Philistine soldier for mountain. Na im e tell the person wey hold the the things wey e take dey fight sey: ‘If Jehovah give us sign, we go fight dem. If Philistine people sey make we come the mountain, we go know sey we go fight dem.’ True true, Philistine people shout sey: ‘Make una come up come fight!’ Their two come climb go the mountain and kill 20 Philistine soldier.

Jonathan give David some of im things

As e be sey na Jonathan be Saul first pikin, na im suppose be the next king. But e know sey Jehovah don choose David to be the next king, this one no make am jealous David. Jonathan and David come be tight friend. Dem promise theirself sey dem go protect and help each other. Jonathan give David im coat, sword, bow and belt to show sey David na im tight friend.

As David dey run from Saul, Jonathan go meet am and tell am sey: ‘No fear, get strong mind. My papa even know sey Jehovah don choose you.’ You go like get better friend like Jonathan?

Jonathan put im life for danger many times to help David. E know sey im papa want kill David, na im e tell im papa sey: ‘Na sin if you kill David, because e no do you anything.’ Saul come dey vex for Jonathan.

After some years, Saul and Jonathan die for war. David come go find Jonathan pikin Mephibosheth. As David see am, e tell am sey: ‘Because your papa na my tight friend, I go take care of you till you die. You go stay my palace and we go chop for the same table.’ David no forget Jonathan at all!

‘Make una love unaself as I love una. Nobody get love wey pass this one, sey one person go die for im friends.’​—John 15:12, 13

Question: How Jonathan take show sey e get mind? How Jonathan take show sey im na better friend?

1 Samuel 14:1-23; 18:1-4; 19:1-6; 20:32-42; 23:16-18; 31:1-7; 2 Samuel 1:23; 9:1-13

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share