Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • lfb lesson 54 p. 130-p. 131 par. 1
  • Jehovah Dey Patient With Jonah

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Jehovah Dey Patient With Jonah
  • Lesson Wey You Fit Learn From Bible
Lesson Wey You Fit Learn From Bible
lfb lesson 54 p. 130-p. 131 par. 1
Water dey carry Jonah go down and one big fish dey swim pass

LESSON 54

Jehovah No Vex for Jonah

Assyria na city for Nineveh, but people wey dey there wicked well well. So, Jehovah tell prophet Jonah make e go Nineveh go warn dem sey make dem stop to dey do bad things. But Jonah no gree go, e run go another place. E enter one big boat wey dey go Tarshish run comot.

As the big boat dey float for the big river, one strong breeze come blow wey make the people wey dey drive the boat fear. Dem pray to their gods ask am sey: ‘Why this thing dey happen to us?’ Jonah come tell dem sey: ‘Na me cause am. I dey run leave the message wey Jehovah send me. Make una throwey me inside the water, the breeze go stop.’ True true, as dem throwey am inside the water, the breeze stop.

Jonah think sey e go die. As the water dey carry am go down, e pray to Jehovah. Na im Jehovah send one big fish go help am. The fish swallow am, but e no kill am. As Jonah dey inside the fish belle, e pray sey: ‘I promise sey I go dey do wetin you talk.’ Jehovah keep Jonah for the fish belle for three days, the fish no kill am. The fish come vomit Jonah for dry land.

Now wey Jehovah don save Jonah, you think sey e no go send Jonah go Nineveh again? For where! Jehovah tell am again sey make e go there. But this time, Jonah no waste tme at all. E tell Nineveh people sey: ‘Na only 40 days remain, God go destroy Nineveh.’ But wetin Jonah no think sey go happen come happen​—⁠the people listen to God and dem repent. Nineveh king tell im people sey: ‘Make we pray to God and repent. E fit no destroy us again.’ As Jehovah see sey the people don repent, e no destroy dem again.

Jonah dey go Nineveh

Jonah come dey vex sey God no destroy dem. Think am: Jehovah dey patient with Jonah and e pity am, but Jonah no pity for Nineveh people. Instead wey e go pity dem, e go sitdown under tree dey squeeze im face. But as the tree die, Jonah come dey vex. Na im Jehovah come tell am sey: ‘You value the tree pass Nineveh people. I pity dem, so I no destroy dem.’ Wetin be the lesson? Jehovah value Nineveh people pass any tree.

‘Jehovah dey patient with una because e no want destroy anybody but e want make everybody repent.’​—2 Peter 3:9

Question: Wetin Jehovah make Jonah know? Wetin we fit learn from wetin happen to Jonah?

Jonah 1:1–4:11

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share