Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • lfb lesson 70 p. 166-p. 167 par. 2
  • Angel Make People Know Sey Mary Don Born Jesus

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Angel Make People Know Sey Mary Don Born Jesus
  • Lesson Wey You Fit Learn From Bible
  • Similar Material
  • When Dem Born Jesus and Where Dem Born Am?
    Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
Lesson Wey You Fit Learn From Bible
lfb lesson 70 p. 166-p. 167 par. 2
Angels dey tell people wey dey take care of sheep sey dem don born Jesus

LESSON 70

Angel Make People Know Sey Mary Don Born Jesus

Caesar Augustus wey dey rule Rome sey make all Jew people go their land go register. Joseph family come from Bethlehem. So Joseph and Mary travel go there. But this time, e don dey near when Mary go born.

When dem reach Bethlehem, the only place wey dem see to sleep na where animal dey stay. Na there Mary for born Jesus. Mary use soft cloth wrap Jesus body, and e sofri put am for where dem dey put animal food.

Near Bethlehem, some people wey dey take care of sheep dey outside dey look their sheep for night. Before dem know, dem see one angel for up. Dem come dey fear, but the angel sey: ‘Make una no fear. I get good news for una. Dem don born the Messiah today for Bethlehem.’ Na im many angel appear for up tell dem sey: ‘Honor and praise to God wey dey heaven, and peace for people wey dey earth.’ Na im the angels comot. Wetin you think sey the people wey dey take care of sheep go do?

Dem tell theirself sey: ‘Make we dey go Jerusalem now now.’ Dem come rush go. As dem reach there, dem see sey Joseph, Mary and Jesus dey where animal dey stay.

Everybody wey hear wetin the angel talk come surprise. Mary think about wetin the angel talk well well and e no forget am. The people wey dey take care of sheep come go continue to dey look their sheep. Dem thank Jehovah for everything wey dem see and hear.

‘I come from God and I dey here. I no come by myself, na im send me.’​—John 8:42

Question: How the angels take make people know sey dem don born Jesus? Who the people wey dey take care of sheep see for Bethelehem?

Luke 2:1-20; Isaiah 9:6

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share