Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • lfb lesson 80 p. 188-p. 189 par. 1
  • Jesus Choose 12 Apostles

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Jesus Choose 12 Apostles
  • Lesson Wey You Fit Learn From Bible
  • Similar Material
  • Jesus Choose Twelve Apostles
    Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
Lesson Wey You Fit Learn From Bible
lfb lesson 80 p. 188-p. 189 par. 1
Jesus and im 12 apostles

LESSON 80

Jesus Choose 12 Apostle

After Jesus don preach for about one year and half, e get one big question wey dey im mind. The question be sey, which people e go draw near body to follow am work? Which people e go train to dey lead for congregation? Jesus want make Jehovah direct am as e want choose this people. E come go mountain where only im go dey, and e pray the whole night. When morning reach, e call some of im disciples and e choose 12 apostle among dem. Which of the apostle name you remember? Their name na Peter, Andrew, James, John, Philip, Bartholomew, Thomas, Matthew, James wey be Alphaeus pikin, Thaddaeus, Simon, and Judas Iscariot.

Andrew, Peter, Philip, James

Andrew, Peter, Philip, James

Twelve of dem go dey travel with Jesus. After Jesus train dem finish, e send dem go preach. Jehovah give dem power to drive demon comot for people body. E still give dem power to cure sick people.

John, Matthew, Bartholomew, Thomas

John, Matthew, Bartholomew, Thomas

Jesus call im 12 apostle im friend, because e trust dem. People wey dem dey call Pharisee think sey the apostles no know anything, and sey dem no go school. But Jesus no look dem like that. E train dem to do their work well. Dem go dey with Jesus anytime e need dem​—before e go die and when God go bring am back to life. Like Jesus, many of the apostles come from Galilee. Some of dem even marry.

James wey be Alphaeus pikin, Judas Iscariot, Thaddaeus, Simon

James wey be Alphaeus pikin, Judas Iscariot, Thaddaeus, Simon

All the apostle no free from sin, so dem dey make mistake. Sometimes, some of dem dey talk before dem think and this one dey make dem do wetin no correct. Sometimes dem no dey dey patient. Dem even argue about who big pass among dem. But all of dem na good people wey love Jehovah. Na dem go dey lead for the congregation when Jesus don go heaven.

‘I dey call una my friend, because I don tell una everything wey I hear from my Father.’​—John 15:15

Question: Which people Jesus choose as im apostles? Which work Jesus give dem?

Matthew 10:1-10; Mark 3:13-19; 10:35-40; Luke 6:12-16; John 15:15; 20:24, 25; Acts 2:7; 4:13; 1 Corinthians 9:5; Ephesians 2:20-22

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share