Wetin Dey Part 3
After the heavy rain for Noah time, people wey come dey serve Jehovah no many. One of dem na Abraham and we still know am as God friend. Wetin make God sey Abraham na im friend? If you be papa or mama, help your pikin see sey God love am and e want help am. Like Abraham and other people like Lot and Jacob wey serve God, we fit beg Jehovah sey make e help us. We dey sure sey Jehovah go do everything wey e don promise.