Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • sjj song 114
  • Dey Wait Like Jehovah

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Dey Wait Like Jehovah
  • “Use All Your Heart Sing” to Jehovah
“Use All Your Heart Sing” to Jehovah
sjj song 114

SONG 114

Dey Wait Like Jehovah

(James 5:8)

  1. 1. Our God wey dey for heaven,

    E no dey take im name dey play.

    Na im we suppose worship,

    No other god fit take im place.

    Some people no respect am,

    Dem dey do wetin dem like.

    Jehovah God dey see dem.

    E just dey give dem time.

    E want make ev’rybody

    Enjoy the life wey no go end.

    Na strong love make Jehovah

    Dey wait for people make dem change.

  2. 2. If we no rush dey do things,

    E go dey help us serve God well.

    E fit give us better mind,

    The mind to love our brothers well.

    E fit help us dey bear things

    Wey dey make this life dey hard.

    Better peace with our brothers,

    Na im we go enjoy.

    When we wait like Jehovah,

    Our hope and joy go just dey flow.

    And this one go dey help us

    To serve the true God wey we know.

(Still check Ex. 34:14; Isa. 40:28; 1 Cor. 13:4, 7; 1 Tim. 2:4.)

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share