Question From People Wey Dey Read Our Book
Why the way people take dey wash their hand come be problem for Jesus enemy?
This one na just one of the many things wey dey make Jesus enemy dem dey vex for am and im disciples. Jehovah tell Israel people for the Law wey e give dem, wetin dem go do to dey clean when some kind things make dem dirty. Things like leprosy, dead body and wetin dey comot for man or woman body. The Law still tell dem how sacrifice and water go fit make dem clean.—Lev., chap. 11-15; Num., chap. 19.
But the people wey be Pharisee and scribe come add other things join wetin the Law talk. How we take know? One book sey dem go want know the things wey make the person dirty; how the dirty fit reach another person; which container fit still dey clean or fit dirty because of the person; and how and wetin dem go use to clean all of dem.
Jesus enemy dem ask am sey: ‘Why e be sey your disciples dey chop food with dirty hand? Why dem no dey follow our people tradition wey don dey, tey tey?’ (Mark 7:5) The Pharisee and Scribe no dey talk about the normal hand wey person dey wash before e chop. But dem dey talk about the law wey dem make by theirself wey be sey, person go dey pour water for their hand before dem chop. The book still talk sey, the Pharisee and Scribe dem still dey argue about which container person go use pour the water, which kind water dem go use, who go pour am, and where dem go wash the hand reach.
Wetin Jesus tell this im enemy dem? E tell dem sey: ‘Isaiah correct when e talk about una wey dey pretend, as dem write am, “Na their mouth this people take dey worship me, but their mind don comot for where I [Jehovah] dey. Dem dey worship me for nothing, because wetin dem dey teach na people law.” Una don leave God law come dey hold people tradition tight.’—Mark 7:6-8.