Name for Bible Wey Dey One Olden Days Pot
For 2012, some people dig pieces of one clay pot come out. The pot don old reach 3,000 years. But e never tey when dem start to talk about am. Why? Because of wetin dem see for the pieces.
Na olden days language dem use write wetin dem see. When the people join the pieces together, dem come fit read wetin dem write for the pot. Wetin dem write na: “Eshba’al Ben [son of] Beda’ (Eshba’al Ben na Beda’ pikin).” This one na the first time wey dem dey see this name for things wey dem dig come out from ground.
But Bible don first talk about one Eshbaal wey be King Saul pikin. (1 Chron. 8:33; 9:39) Professor Yosef Garfinkel wey dey among the people wey see this pot, talk sey: ‘E good to know sey na for only King David time Bible talk about this name wey be Eshba’al and now, this pot wey we see support wetin Bible talk.’ Some people talk sey na name wey people wey live that time bear. We don see another thing wey show sey wetin dey Bible na true.
For another place for Bible, dem call this name Ish-bosheth. Dem use “bosheth” instead of “baal.” (2 Sam. 2:10) Why dem do am? People wey know about this matter talk sey: ‘For II Samuel, e fit be sey dem no use the name Eshba’al so that people no go dey think about Canaan people god wey be Ba’al. But dem write the real name for Book of Chronicles.’