Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • w17 June pp. 14-15
  • No Put Eye For Only How Person Be For Outside

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • No Put Eye For Only How Person Be For Outside
  • Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2017
Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2017
w17 June pp. 14-15
One man wey im name na Peter, no get where to stay

No Put Eye for Only How Person Be for Outside

E GET one brother for Canada wey im name na Don. E dey try make e fit preach to people wey dey sleep for street because dem no get where to stay. One of the people wey e preach to na Peter. Don talk sey: ‘Peter dirty well well. Im face no good at all and e no dey gree make people near am. Even when people want do good for am, e no dey allow dem.’ But that one no make Don stop to do am good. E pass 14 years wey Don dey try make e help this man.

Don dey preach to Peter for street

One day, Peter come ask Don sey: ‘Why you dey worry yourself about me? Other people dey leave me waka their own. So, why you no want leave me?’ Don come read three verse for Bible wey e feel sey go touch Peter mind. E first ask Peter whether e know sey God get name. E come tell am make e read Psalm 83:18 wey talk about God name. To let am know why e no want leave am, e still show am Romans 10:13, 14 wey talk sey, ‘Anybody wey dey call Jehovah name go save.’ Last last, Don come read Matthew 9:36 and e come tell Peter make e read am by imself. That verse talk sey: ‘As Jesus see how the people plenty reach, e come pity for dem, because dem confuse and dem no get who go help dem, like sheep wey no get shepherd.’ As Peter read am, tears come dey comot from im eye. E come ask Don sey: ‘I be one of this sheep?’

Peter come start to change. E come dey bath, e shave im beard beard make e fine, and e come dey wear the fine fine cloth wey Don give am. From that time, Peter come dey fine.

Peter get one small book wey e take dey write things about imself. E first dey write things wey no make am happy. But the things wey e later dey write, come different. For one place, e write sey: ‘Today, I learn about God name. Now, when I dey pray, I fit pray to Jehovah. Na better thing to know God name. Don talk sey Jehovah fit be my friend. E still talk sey Jehovah ready anytime to hear wetin I want talk, no matter wetin e be.’

The last thing wey Peter write for im book, na for im junior brother and senior sister. E sey:

‘I don old, and I no too well today. But even if na today I go die, I know sey I go see my friend [Don] again for Paradise. If you dey read this thing wey I write, e mean sey I don die be that. But if you see one man wey different from other people wey go come my burial, talk to am. Abeg, still read this small blue book [e dey talk about one book wey we take dey study Bible, wey dem give am tey tey, the name na “The Truth That Leads to Eternal Life”].a The book talk sey I go see my friend again for Paradise. I really believe wetin the book talk. Your brother, Peter.’

After the burial, Ummi wey be Peter sister talk sey: ‘E don reach two years now wey Peter try reach me. E don tey wey I see am dey happy like that and e even smile.’ Ummi tell Don sey: ‘I go read this book because anything wey fit change my brother like this na better thing.’ E still gree make one Jehovah Witness come dey study Bible with am. Na What Does the Bible Really Teach? dem dey use.

Don still dey preach to Peter, wey don dey bath and wear better cloth

Na different kind of people we dey see as we dey preach. So, make we take am easy with dem and show dem real love. (1 Tim. 2:3, 4) Like Brother Don, make we no dey put eye for only how person be for outside. If we dey do like that, we fit help people wey be like Peter. Dem fit no fine for body but dem get better mind. We dey sure sey Jehovah wey ‘dey see wetin dey person mind,’ go make the truth grow for inside this kind people mind.​—1 Sam. 16:7; John 6:44.

a Na Jehovah Witness people print am but we no dey print am again.

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share