Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • w17 August p. 32
  • Question From People Wey Dey Read Our Book

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Question From People Wey Dey Read Our Book
  • Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2017
  • Similar Material
  • Mary Get Belle When E Never Marry
    Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2017
w17 August p. 32

Question From People Wey Dey Read Our Book

Some things wey Matthew and Luke write about Jesus family and when e dey small, dey different. Why e be like that?

Matthew and Luke write about things wey happen before dem born Jesus. Dem still write about things wey happen when e dey small. But wetin two of dem write different small. Na so because Matthew write many things about Joseph. But Luke write many things about Mary.

Matthew tell us wetin Joseph do when e know sey Mary get belle. E talk how angel take appear to Joseph for dream. For the dream, e tell am how Mary take get belle. And how Joseph take follow wetin the angel tell am. (Matt. 1:19-25) Matthew tell us how angel take tell Joseph for dream sey make dem run comot go Egypt. E talk about how Joseph take run comot with im family. For another dream, angel come tell am make dem go back to Israel. E tell us how dem take go back to Israel. And how Joseph and im family begin stay for Nazareth. (Matt. 2:13, 14, 19-23) For Matthew chapter one and two, Matthew use Joseph name eight times. But e use Mary name only four times.

Luke talk about how angel Gabriel take visit Mary, how Mary take go visit Elizabeth wey be im family member, and wetin Mary talk to praise Jehovah. (Luke 1:26-56) Luke still talk wetin Simeon tell Mary about wetin Jesus go suffer for front. Luke talk about wetin happen when Mary and im family go temple. That time, Jesus dey 12 years. Luke even tell us wetin Mary talk when dem see Jesus, but e no tell us wetin Joseph talk. Luke show sey all this things wey happen really affect Mary. (Luke 2:19, 34, 35, 48, 51) For Luke chapter one and two, Luke use Mary name reach 12 times. But e use Joseph name only 3 times. So we don see sey, Matthew talk many things about Joseph pass Mary. E tell us wetin dey Joseph mind and wetin e do. But Luke tell us many things about Mary pass Joseph. E tell us wetin dey Mary mind, and things wey happen to Mary.

Wetin Matthew write about the family wey Jesus come from, dey different from Luke own. Matthew write all the name of the family wey Joseph come from. Wetin e write show sey na Jesus get right to be King for David family. Why e be like that? Even though sey Joseph no be Jesus real papa, e take Jesus as im pikin. And Joseph come from the family of King David pikin wey be Solomon. (Matt. 1:6, 16) But, Luke write all the name of the family wey Mary come from. Wetin e write show sey Jesus still get right to be King from im mama side. (Rom. 1:3) Why e be like that? Na Mary born Jesus. And Mary come from the family of King David pikin wey be Nathan. (Luke 3:31) But, when Luke dey mention the family name wey Mary come from, why e no write sey Mary na Heli pikin? Na because if dem dey trace something like that, na from the man side dem dey trace am; no be woman side. Joseph na Mary husband, and Heli na Mary papa. So na because of that one Luke write sey Joseph na Heli pikin.​—Luke 3:23.

Wetin Matthew and Luke write about the family wey Jesus come from show sey Jesus na the Messiah wey God promise sey go come. Even the Pharisee and Sadducee people know sey Jesus come from King David family. Dem no fit argue am. Today, wetin Matthew and Luke write about the family wey Jesus come from, na something wey dey make our faith strong. E still dey give us the mind sey, all the things wey Jehovah promise must happen.

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share