Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • w17 December p. 16-p. 17 par. 8
  • Question From People Wey Dey Read Our Book

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Question From People Wey Dey Read Our Book
  • Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2017
Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2017
w17 December p. 16-p. 17 par. 8
One husband and wife dey do research about IUD (intrauterine device)

Question From People Wey Dey Read Our Book

E bad for Christian wey don marry to use wetin dem dey call IUD (intrauterine device) if dem no want born pikin?

Na husband and wife go choose wetin dem go do about this matter. But e good make dem sitdown look how this IUD take dey work. And e still good make dem check wetin Bible talk, so that dem no go choose wetin go worry their conscience.

When Jehovah make Adam and Eve, e command dem sey: ‘Make una born children and make una full this earth.’ And Jehovah still tell Noah and im family the same thing after the heavy rain wey fall. (Gen. 1:28; 9:1) But Bible no talk sey make Christian follow this command. So na husband and wife go choose wetin dem go use if dem never ready to born pikin, or if dem no want born plenty children. But wetin e good make dem put for mind?

If husband and wife wey dey serve Jehovah no want born pikin, dem need to check wetin Bible talk before dem choose wetin dem want use. But dem no go do abortion. Since abortion show sey person no value life, Bible no support am at all. So e no good to kill pikin wey dey inside belle, because the pikin don already get life. (Ex. 20:13; 21:22, 23; Ps. 139:16; Jer. 1:5) But dem fit use IUD?

The Watchtower of May 15, 1979, page 30-31 talk about this matter. Many of the IUD wey dem dey see that time na the one wey dem use rubber make. Dem dey put am for inside woman belle (where pikin dey grow), so that e no go get belle. The Watchtower still talk sey dem no too know how the IUD take dey work. Many science people talk sey this IUD dey make man sperm no reach where the woman egg dey. And if the man sperm and the woman egg no meet, the woman no fit get belle.

But e get wetin show sey, sometimes, the sperm fit still reach where the egg dey. And when the egg and sperm meet, two things fit happen: (1) The egg wey the sperm meet fit start to dey grow before e reach the belle, where the pikin suppose grow, or (2) e fit reach the belle before e start to grow. If na the second one happen, the IUD fit stop am make e no grow. The pikin wey don find where e go stay dey grow go die, and this one go be like abortion. The Watchtower come talk sey: “Better Christian go think about this things and wetin Bible talk about how we suppose value life. This one go help am know whether e good or bad to use IUD.”​—Ps. 36:9.

Since the time wey dem write that Watchtower for 1979, science people don do many new things.

E get two type of IUD wey many people dey use today. One get copper and people for United States start to dey use am well well for 1988. The other one dey release hormone (chemical wey dey work for body). Na 2001 dem start to sell this one. But how this two type of IUD take dey work?

Copper IUD: As we talk before, IUD dey make am hard for man sperm to reach where woman egg dey. Apart from that one, the IUD wey get copper dey fit kill the sperm wey enter inside woman body. Na the copper wey dey this IUD dey kill the sperm.a Dem still talk sey this IUD wey get copper dey affect where pikin dey grow for woman belle (womb).

Hormone IUD: E get different type of IUD wey get hormone. The hormone wey this IUD get just still be like the one wey dey tablet wey women dey take so that dem no go get belle. The IUD dey release the hormone for where pikin dey grow for woman belle. For some women, the hormone dey make dem no release egg. And woman no go fit get belle if e no release egg. But apart from this one, dem believe sey the hormone wey this IUD get dey make woman belle no be as e suppose be for pikin to fit stay and grow.b When man sperm enter inside woman body, e get where e go pass (cervix) before e reach where pikin dey grow for woman belle. But the hormone dey make wetin dey that place (mucus) thick so that the sperm no go fit pass.

We don see sey the copper IUD and the one wey get hormone dey affect where pikin dey grow for woman belle. But what if the man sperm meet the woman egg? E go form pikin, and the pikin wey don form fit reach were e suppose stay for the woman belle. But since the hormone don affect the woman belle, the pikin go die because e no go see where stay. This kind thing fit still happen if woman dey take tablet make e no get belle. But e dey hard for this kind thing to happen.

Nobody fit talk sey if woman dey use copper or hormone IUD, man sperm no go ever fit meet the woman egg for pikin to form. But science people don see sey because of the things wey this IUD dem dey do, e go hard for the woman wey dey use am to get belle.

If husband and wife dey think sey dem go like use IUD, make dem first tell doctor. The doctor go tell dem the kind IUD wey dem fit get for their area. E go still tell dem the gain and the problem wey the IUD fit cause for the woman body. Make the husband and wife no let doctor or another person choose for dem. (Rom. 14:12; Gal. 6:4, 5) Na two of dem go choose the one wey dem go use. But make dem choose wetin go make God happy, and wetin no go make their conscience judge dem.​—Check 1 Timothy 1:18, 19; 2 Timothy 1:3.

a England National Health Service talk sey, the IUD wey get plenty copper dey work pass the one wey get small copper. Dem sey “if hundred women use IUD for one year, e go hard for even one of dem to get belle.”

b Because of this one, if the blood wey dey come out of woman body every month too much, doctor fit advice am to use this IUD wey get hormone even if e never marry. Why? Because this IUD dey reduce am.

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share