Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • mwb16 April p. 4
  • Job No Let Imself Think About Things Wey No Be True

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Job No Let Imself Think About Things Wey No Be True
  • Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book (2016)
  • Similar Material
  • Who Job Be?
    Lesson Wey You Fit Learn From Bible
Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book (2016)
mwb16 April p. 4

BETTER THINGS WEY DEY INSIDE BIBLE | JOB 21-27

Job No Let Imself Think About Things Wey No Be True

Job cover im ear

Satan dey use lie lie to make people wey dey serve Jehovah stop to dey serve am. See wetin different for the lie wey Satan dey talk and how Jehovah really feel for the Bible book of Job. Write other place for Bible wey show you sey Jehovah dey care for you true true.

LIE LIE WEY SATAN DEY TALK

HOW JEHOVAH DEY FEEL TRUE TRUE

E no get anything wey people wey dey serve God fit do wey go make God happy because im way too high. For everything wey God make, e no get anyone wey fit make am happy (Job 4:18; 25:5)

Jehovah dey happy as we dey try to serve am (Job 36:5)

People dey useless for God eye (Job 22:2)

Jehovah dey see us as we dey do everything wey we fit do to serve am, and e go bless us (Job 33:26; 36:11)

E no concern God if you dey righteous (Job 22:3)

Jehovah dey protect people wey dey righteous (Job 36:7)

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share