May 23-29
PSALMS 19-25
Song 116 and Prayer
Wetin Meeting Chairman Go Talk to Start the Meeting (No pass 3 min.)
BETTER THINGS WEY DEY INSIDE BIBLE
“Wetin Dem Talk Tey Tey Show Wetin Go Happen to the Messiah”: (10 min.)
Ps 22:1—E go be like sey God don leave the Messiah (w11 8/15 15 ¶16)
Ps 22:7, 8—People go hate the Messiah (w11 8/15 15 ¶13)
Ps 22:18—Dem throw seed to win the Messiah garment (w11 8/15 15 ¶14)
Better Things Wey Dey Inside Bible—Find Am Well: (8 min.)
Ps 19:14—Which better lesson we fit learn from this verse? (w06 5/15 19 ¶8)
Ps 23:1, 2—How Jehovah take be like good shepherd? (w02 9/15 32 ¶1-2)
Wetin I learn about Jehovah from the place wey we read for Bible this week?
Wetin I learn from the place wey we read for Bible this week wey I fit use for preaching?
Bible Reading: (No pass 4 min.) Ps 25:1-22
MEK YOU DEY PREACH WELL
First Time: (No pass 2 min.) bh—Read Bible from phone or small computer.
Return Visit: (No pass 4 min.) bh—Use the place wey dem write ‘search’ for JW Library, to find the Bible verse wey answer the question wey who you dey study ask.
Bible Study: (No pass 6 min.) bh 129-130 ¶11-12—Use small time show who you dey study how e go take use JW Library prepare for study with im phone.
MEK WE DEY LIVE LIKE CHRISTIAN
Song 55
“Different Different Way Wey You Fit Use JW Library”—Part 2: (15 min.) Talk am together. Play and use small time talk about this two video: Download and Manage Bibles and Search in a Bible or Publication. After una watch am finish, mek una talk about the last small topic wey dey the back of this meeting book. Ask people for meeting other way wey dem don use JW Library for preaching.
Congregation Bible Study: (30 min.) ia chap. 16 ¶1-15
Wetin We Learn and Wetin We Go Learn Next Week? (3 min.)
Song 139 and Prayer