June 6-12
PSALMS 34-37
Song 95 and Prayer
Wetin Meeting Chairman Go Talk to Start the Meeting (No pass 3 min.)
BETTER THINGS WEY DEY INSIDE BIBLE
“Trust Jehovah and Do Wetin Good”: (10 min.)
Ps 37:1, 2—Dey use all your mind serve Jehovah, no dey think about the bad people wey be like sey dem succeed for wetin dem dey do (w03 12/1 9-10 ¶3-6)
Ps 37:3-6—Trust Jehovah, do good, and e go bless you (w03 12/1 10-12 ¶7-15)
Ps 37:7-11—Get patient and wait make Jehovah comot wicked people (w03 12/1 13 ¶16-20)
Better Things Wey Dey Inside Bible—Find Am Well: (8 min.)
Ps 34:18—How Jehovah dey help ‘people wey pain full their heart’ and ‘people wey no get any hope’? (w11 6/1 19)
Ps 34:20—How wetin Bible talk for here take happen to Jesus? (w13 12/15 21 ¶19)
Wetin I learn about Jehovah from the place wey we read for Bible this week?
Wetin I learn from the place wey we read for Bible this week wey I fit use for preaching?
Bible Reading: (No pass 4 min.) Ps 35:19–36:12
MAKE YOU DEY PREACH WELL
Prepare How You Go Take Give People Book This Month: (15 min.) Talk am together. Play the video wey show the example wey we fit follow and talk about am. Tell all the publisher sey e good make dem try write as dem go take do their own if dem go preach.
MAKE WE DEY LIVE LIKE CHRISTIAN
Song 93
“Wetin We Go Do to Make How We Dey Preach Better—Dey Use Video Teach People”: (15 min.) Talk am together. If you want explain the point wey dey under the small topic wey be “How You Go Do Am,” use this video wey dey for jw.org: Who Is the Author of the Bible? (Press PUBLICATIONS > BOOKS & BROCHURES. Find Good News brochure for there. The video dey under the lesson wey get this topic: “Is the Good News Really From God?”)
Congregation Bible Study: (30 min.) ia chap. 17 ¶1-13
Wetin We Learn and Wetin We Go Learn Next Week? (3 min.)
Song 61 and Prayer