July 10-16
EZEKIEL 15-17
Song 11 and Prayer
Wetin Meeting Chairman Go Talk to Start the Meeting (No pass 3 min.)
BETTER THINGS WEY DEY INSIDE BIBLE
“You Dey Do Wetin You Promise?”: (10 min.)
Eze 17:1-4—Babylon King comot Jehoiachin as king come put Zedekiah (w07 7/1 12 ¶6)
Eze 17:7, 15—Zedekiah no do wetin e promise, but e go meet Egypt people make dem help am (w07 7/1 2 ¶6)
Eze 17:18, 19—Jehovah want make Zedekiah do wetin e promise (w12 10/15 30 ¶11; w88 9/15 17 ¶8)
Better Things Wey Dey Inside Bible—Find Am Well: (8 min.)
Eze 16:60—Wetin be the ‘agreement wey no go end,’ and who Jehovah make am with? (w88 9/15 17 ¶7)
Eze 17:22, 23—Who be the ‘fresh part’ of the tree wey Jehovah talk sey e go plant? (w07 7/1 12 ¶6)
Wetin you learn about Jehovah from the place wey we read for Bible this week?
Which other better thing you don see from the place wey we read for Bible this week?
Bible Reading: (No pass 4 min.) Eze 16:28-42
MAKE YOU DEY PREACH WELL
First Time: (No pass 2 min.) wp17.4 cover—Tell am wetin una go talk about when you come back.
Return Visit: (No pass 4 min.) wp17.4 cover—Talk about the video: Why E Good Make We Learn Bible? But no play am.
Bible Study: (No pass 6 min.) fg lesson 11 ¶1-2—Invite the person come meeting.
MAKE WE DEY LIVE LIKE CHRISTIAN
Even If Your Marriage Don Tire You, Still Dey Do Wetin You Promise: (10 min.) Use March 2014 Awake! page 14-15 for this talk. Na elder go give am.
Make You Be Jehovah Friend—No Dey Lie: (5 min.) Play this video, Make You Be Jehovah Friend—No Dey Lie. After, call some children wey you don choose come platform and ask dem some question about the video.
Congregation Bible Study: (30 min.) kr chap. 15 ¶1-8
Wetin We Learn and Wetin We Go Learn Next Week? (3 min.)
Song 137 and Prayer