BETTER THINGS WEY DEY INSIDE BIBLE | NAHUM 1–HABAKKUK 3
Ready at Any Time to Do Wetin Jehovah Want
Hab 1:5, 6
Before Babylon people destroy Judah, e no even be like sey Babylon people go fit do anything. That time, Egypt dey control Judah and Egypt get power pass Babylon. Another thing be sey, many people no believe sey Jehovah go allow Babylon destroy Jerusalem and the temple. As e be sey wetin God talk must happen, Habakkuk need to wait for am. And e still need to ready at any time and use all im mind do Jehovah work.
Why I dey sure sey the end of this world don near well well?
Wetin I go do so that I go ready at any time to do Jehovah work, and use all my mind serve am?