Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • mwb17 December p. 5
  • New Meeting Part

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • New Meeting Part
  • Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book—2017
Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book—2017
mwb17 December p. 5
The Gospel of Matthew for online study edition of New World Translation

MAKE WE DEY LIVE LIKE CHRISTIAN

New Meeting Part

From January 2018, our Life and Preaching Meeting go get part wey be study note and media. Na from our online study edition Bible (nwtsty) we carry am. You go use this study edition, even if e never dey for your language. We dey sure sey the things wey dey there go help you prepare well for meeting. And our prayer be sey, this part go help you near Jehovah more more!

STUDY NOTE

The study note go help us understand many Bible verse more. E go explain how people dey live that time, how the area be, and some word wey dem use.

Matthew 12:20

Smoldering wick: The lamp wey many people dey use for house that time resemble small kettle wey dem use clay make. Dem dey put olive oil inside the lamp to make the lamp thread produce light. The Greek word wey be “smoldering wick,” fit mean lamp thread wey dey bring smoke because small fire still dey am, even though sey the light want quench or e don quench. Isaiah 42:3 talk how Jesus go take treat people. E no go ever quench the last hope wey poor people get.

Matthew 26:13

Truly: The Greek word a·menʹ wey dem dey spell ʼa·menʹ for Hebrew language, mean “I agree,” or “true true.” Jesus dey use this word well well when e want start to talk, when e want make promise, or when e want talk wetin go happen for front. E dey use am show sey wetin e talk must happen. Dem talk sey na only for the four Gospel book, Jesus use the word “truly,” or amen. When e talk am two times, (a·menʹ a·menʹ) as e dey for Gospel of John, dem dey translate am as “most truly.”​—Joh 1:51.

MEDIA

Na pictures, drawing, silent video and cartoon wey show more about some things wey dey Bible.

Bethphage, Mount of Olives, and Jerusalem

This short video dey show how person wey dey et-Tur fit enter Jerusalem. For Bible time, na Bethphage dem dey call et-Tur and e dey the east side of Jerusalem. From there, person go climb Mount of Olives before e fit enter Jerusalem. But another town wey be Bethany dey the east side of Bethphage. If you dey ontop Mount of Olives, you go come down from the east side, before you reach Bethany. When Jesus and im disciples dey Jerusalem, na Bethany dem dey normally sleep. Today, na one Arabic name wey be el-ʽAzariyeh (El ʽEizariya) dem dey call Bethany. This name mean “Lazarus Place.” We dey sure sey Jesus stay with Martha, Mary, and Lazarus for their house. (Mt 21:17; Mr 11:11; Lu 21:37; Joh 11:1) E fit be sey Jesus follow the road wey we show for the video when e comot from their house dey go Jerusalem. For Nisan 9, 33 C.E., when Jesus use donkey pass Mount of Olives enter Jerusalem, e fit be sey na from Bethphage, e enter Jerusalem.

E fit be sey Jesus follow this road from Bethany to Jerusalem
  1. Road from Bethany to Bethphage

  2. Bethphage

  3. Mount of Olives

  4. Kidron Valley

  5. Temple Area

Nail wey dey Heel Bone

Human being heel bone wey dem nack nail enter

This na picture of person heel bone wey dem mold. Dem nack 4.5 inches iron nail for the bone. Na 1968 dem see the original heel bone wey dem look take make this one. And na when people dey dig for the north side of Jerusalem dem see am. E resemble wetin dem bury when Rome people dey rule. This one show sey that time, dem fit nail person join pole if dem want kill am. This nail fit be the same type of nail wey Rome soldiers take nail Jesus join pole. Dem see this heel bone for inside one stone box wey dem dey call ossuary. Na inside the box dem dey put human being bone wey don dry. This one show sey, dem fit still dey bury person wey dem nail for pole.​—Mt 27:35.

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share