January 22-28
MATTHEW 8-9
Song 17 and Prayer
Wetin Meeting Chairman Go Talk to Start the Meeting (No pass 3 min.)
BETTER THINGS WEY DEY INSIDE BIBLE
“Jesus Show Sey E Love People”: (10 min.)
Mt 8:1-3—Jesus really show how e pity one leper reach (“e touch am,” “I want do am” nwtsty—mwbr18.01)
Mt 9:9-13—Jesus love people wey other people no like (“dey chop,” “tax collectors” nwtsty—mwbr18.01)
Mt 9:35-38—Because Jesus love people, e preach to dem even when e tire and e pray make God send more workers (“pity for dem” nwtsty—mwbr18.01)
Better Things Wey Dey Inside Bible—Find Am Well: (8 min.)
Mt 8:8-10—Wetin we fit learn from the way Jesus talk to the army officer? (w02 8/15 13 ¶16—mwbr18.01)
Mt 9:16, 17—Wetin the two example wey Jesus use for this verse mean? (jy 70 ¶6—mwbr18.01)
Wetin you learn about Jehovah from the place wey we read for Bible this week?
Which other better thing you don see from the place wey we read for Bible this week?
Bible Reading: (No pass 4 min.) Mt 8:1-17
MAKE YOU DEY PREACH WELL
Second Return Visit: (No pass 3 min.) Follow the example wey dey front page. Invite the person come meeting.
Third Return Visit: (No pass 3 min.) Choose the Bible verse wey you go use, and give am any book wey we dey use study Bible with people.
Bible Study: (No pass 6 min.) bhs 47 ¶18-19
MAKE WE DEY LIVE LIKE CHRISTIAN
“True True, God Make Am Lord and Christ.”—Part 1, Short video: (15 min.) Talk Am Together. After una read Matthew 9:18-25 and watch the short video finish, make una answer this three question:
How Jesus take show sey e care about the sick woman and Jairus?
Wetin the miracle wey Jesus do teach you about how life go be for God Kingdom?
Like Jesus, how you fit show sey you love other people?
Congregation Bible Study: (30 min.) jy chap. 5
Wetin We Learn and Wetin We Go Learn Next Week? (No pass 3 min.)
Song 95 and Prayer