PART 4
Wetin Come Happen as Dem Do Wetin Satan Talk?
Adam and Eve die because dem no do wetin God talk. Genesis 3:6, 23
Eve do wetin the snake tell am, e come chop the fruit. After, when Adam come, Eve give am the fruit and Adam self collect am chop.
Wetin dem do no good—na sin. God come pursue dem comot for Paradise.
As dem comot for Paradise, life no come easy for dem and their pikin. Before dem know, dem don old come even die. As dem die, dem turn to sand sand wey God take make dem.
As sand sand no get life, na so people wey don die no get life. Genesis 3:19
We dey die today because we be Adam and Eve pikin. People wey don die no fit see, hear, or do anything again.—Ecclesiastes 9:5, 10.
The time wey God make people, e no get am for mind sey make dem dey die. Na im make God talk sey, small time e go bring people wey don die come life again. If dem do wetin e tell dem, dem go enjoy life wey no go end.