Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • ll part 8 pp. 18-19
  • Wetin We Fit Gain as Jesus Die for Us?

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Wetin We Fit Gain as Jesus Die for Us?
  • Listen to God Make You Live Forever
  • Similar Material
  • Wetin Be God Kingdom?
    Wetin Bible Dey Teach Us?
  • God Go Bring People Wey Don Die Back to Life!
    Wetin Bible Dey Teach Us?
  • Wetin Be God Kingdom?
    Good News Wey Come From God!
Listen to God Make You Live Forever
ll part 8 pp. 18-19

PART 8

Wetin We Fit Gain as Jesus Die for Us?

Jesus die make we fit get life. John 3:16

Some women dey look Jesus’ grave wey empty

As e reach three days wey Jesus die, Mary Magdalene with other women go where dem bury am. But dem no see Jesus because Jehovah don bring am come life again.

Jesus show im apostles sey God don bring am come life, later e come go heaven

After, Jesus come show im apostle dem sey God don bring am come life again.

True true, Jehovah don bring Jesus come back to life, come make am make e no fit die again. Jesus disciple dem see am as e dey go heaven.

  • Wetin sin dey cause?—Romans 6:23.

  • Na Jesus show us road to take get life wey no go end.—Romans 5:21.

God bring Jesus come life again and make am King for im Kingdom. Daniel 7:13, 14

Jesus sitdown for im throne dey rule everybody for this earth when e don turn paradise

Jesus die to comot us from sin. (Matthew 20:28) Na im make God fit give us life wey no go end.

Jehovah don choose Jesus make e be king wey go rule this world. E still choose 144,000 people wey go follow am rule, and na from this world e carry dem. Na Jesus and this 144,000 go join hand rule for that government wey dey heaven wey dem dey call God Kingdom—Revelation 14:1-3.

Na that kingdom go make this world paradise. People no go fight war again. Bad things no go dey happen, and people no go suffer again. Food go plenty. This one go make everybody happy well well. —Psalm 145:16.

  • Wetin we go enjoy when God Kingdom go make this world paradise?—Psalm 72.

  • Pray make God Kingdom come.—Matthew 6:10.

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share