LESSON 25
Why We Dey Build Kingdom Hall and How We Take Dey Build Am?
Bolivia
Nigeria, before and after
Tahiti
Everything wey we dey learn for our Kingdom Hall na about God Kingdom. And na that Kingdom be the main thing wey Jesus preach when e dey for this world. Na im make we dey call am Kingdom Hall.—Luke 8:1.
Na place wey you fit worship God the way wey e want. Na Kingdom Hall, Jehovah Witness people dey learn plenty plenty things wey dey help dem sabi how to preach well well. (Matthew 24:14) Kingdom Hall get different different size. But, all of dem dey simple and clean. Plenty congregation fit use one Kingdom Hall. Today, we don build plenty plenty Kingdom Hall, (like five everyday) make everybody worship Jehovah for better place. How we take dey do am?—Matthew 19:26.
Dem dey build am with money wey people take their mind give. All this money dey go our branch office. Na from there we dey comot money build Kingdom Hall and repair any one wey don old.
People wey dey build am come from different different place and dem no dey collect salary. Na Kingdom Hall Construction Group dey do this work for different different country. This people dey travel go different different village or town to build Kingdom Hall for the congregation wey dey their country. For other country, dem choose some brother wey love Jehovah and sabi the work well well, make dem dey check how the work dey move for their area. Na plenty people wey dey use the Kingdom Hall dey help do the work. Na Jehovah spirit dey help dem do this work.—Psalm 127:1; Colossians 3:23.
Why we dey call the place wey we dey worship God Kingdom Hall?
How we manage take dey build Kingdom Hall for everywhere?