CHAPTER 10
Joseph Carry Im Family Go Jerusalem
LUKE 2:40-52
JESUS DEY ASK TEACHERS QUESTION WHEN E DEY TWELVE YEARS
JESUS TALK SEY JEHOVAH NA IM FATHER
E don reach time for Joseph to carry im family go Jerusalem. Every year, dem dey go do Passover for there, as the Law talk. (Deuteronomy 16:16) Dem dey go with their friends and family people. From Nazareth to Jerusalem na about 120 km. Everybody dey like make this time quick reach, and many things dey to do. Now, Jesus don reach 12 years, and this festival really dey make am happy. E still dey happy because e go see the temple again.
For their family, this Passover no be just one day matter. After the Passover, dem go still do Festival of Unleavened Bread for seven days. (Mark 14:1) This festival na still part of wetin dem dey do around Passover time. To go Jerusalem, do the Passover, and come back to Nazareth, go take about two weeks. But this year, dem stay pass two weeks because of something wey happen. And na when dem dey road dem notice am.
As all of dem dey go back, Joseph and Mary think sey Jesus dey with other people wey dem dey travel with. Na when dem reach where dem want sleep, dem see sey Jesus no dey with dem. Dem come start to dey find am for where their friends dey, but dem no see am. Dem no know where their pikin, Jesus dey, Joseph and Mary come go back to Jerusalem go find am.
Dem use the whole day find am, but dem no see am. Dem no still see am after the second day. Na the third day dem come see am for inside one of the hall for the temple. Jesus sitdown with some of the teachers for the temple. As e dey listen to dem, and dey ask dem question, the teachers come dey surprise for the kind sense wey e get.
As Mary see am, e come ask am sey: “My pikin, why you do us like this?” E still talk sey: “Me and your papa no fit rest, we don dey find you up and down.”—Luke 2:48
Wetin Jesus talk show sey e surprise am sey dem no know where e dey. E ask dem sey: “Why una dey find me? Una no know sey I must dey my Father house?”—Luke 2:49.
Now wey dem don see Jesus, dem come go back to Nazareth, where their house dey. Jesus continue to obey im papa and mama. E continue to grow and e come dey get sense more more. Even though sey e still dey young, God and people dey happy with am. Na since when Jesus small e don dey show good example. E serve Jehovah well, and e respect im papa and mama.