CHAPTER 22
Four Disciples Go Be Fishers of Men
MATTHEW 4:13-22 MARK 1:16-20 LUKE 5:1-11
JESUS CHOOSE DISCIPLES WEY GO FOLLOW AM FULL-TIME
FROM FISHER MEN TO FISHERS OF MEN
After Nazareth people try to kill Jesus, e comot from there go Capernaum, near the Sea of Galilee wey dem still dey call “the Lake of Gennesaret.” (Luke 5:1) Na so wetin prophet Isaiah write take happen, sey Galilee people wey dey stay near the sea go see great light.—Isaiah 9:1, 2.
As Jesus dey Galilee, e continue to preach sey: “The Kingdom wey dey heaven don near.” (Matthew 4:17) Jesus come see four of im disciples. Dem be travel with am, but as dem come back with Jesus from Judea, dem go back to their fish business. (John 1:35-42) Now, time don reach for dem to stay with Jesus so that e go fit train dem to do the preaching work well after e go.
As Jesus dey waka for the corner of the sea, e see Simon Peter, and im brother Andrew, and some of their friends dey arrange their nets. Jesus waka meet dem, enter Peter boat and tell am sey make e move the boat enter water. As dem go front small, Jesus sit down, come dey teach the people wey gather for the corner of the river, the truth about God Kingdom.
After, Jesus tell Peter sey, “drive go where deep, and throw your net inside so that e go catch fish.” Peter come answer Jesus sey: “Teacher, we don work overnight, but we no catch anything, but as you talk, I go throw the net inside.”—Luke 5:4, 5.
As dem throw the net inside water, the fish wey dem catch plenty so tey their net start to dey tear! Quick quick, dem call other people wey dey another boat make dem come help dem. Before dem know, the two boat don full with fish, and the boat dem come dey sink. When Peter see wetin happen, e kneel down for Jesus front, come tell am sey: “Lord, make you dey go, because I be sinner.” Jesus answer am sey: “No dey fear again. From now, na people you go dey catch alive.”—Luke 5:8, 10.
Jesus tell Peter and Andrew sey: “Make una follow me, and I go make una fishers of men.” (Matthew 4:19) Jesus choose two other fishermen James and John, wey be Zebedee children. Dem no waste time to follow Jesus. So this four men abandon their fish business, come be the first disciples wey follow Jesus full-time.