Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • jy chap. 49 p. 122-p. 123 par. 3
  • E Preach for Galilee and E Train Im Apostles

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • E Preach for Galilee and E Train Im Apostles
  • Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
  • Similar Material
  • Dem Ready to Preach Even When Wahala Come
    Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
  • Jesus Preach About God Kingdom
    Lesson Wey You Fit Learn From Bible
Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
jy chap. 49 p. 122-p. 123 par. 3

CHAPTER 49

E Preach for Galilee and E Train Im Apostles

MATTHEW 9:35–10:15 MARK 6:6-11 LUKE 9:1-5

  • JESUS PREACH ROUND GALILEE AGAIN

  • E SEND IM APOSTLES MAKE DEM GO PREACH

Jesus don dey preach for about two years now. Time don reach for am to slow down or relax? For where! Jesus even dey preach more more. E start to “dey waka round all the city and village, dey teach for their synagogue and dey preach the good news about the Kingdom and dey cure all kind of disease and all kind of sickness.” (Matthew 9:35) Wetin Jesus see make am believe sey the preaching work suppose reach more people. But how e go take do am?

As Jesus dey travel, e see sey many people need to hear the truth from God Word wey go help dem and make their mind come down. The people just dey suffer like sheep wey no get shepherd. Jesus pity for dem and e tell im disciples sey: “True true, things to harvest plenty, but the workers small. So, beg the Master of the harvest to send workers come im harvest.”—Matthew 9:37, 38.

Jesus know wetin go make the work move. E gather the 12 apostles and e share dem two two. So dem come be six group of people wey go dey preach. E tell dem how dem go do the work. E sey: “Make una no enter the road of the nation and make una no enter any Samaritan town; but, make una continue to find the lost sheep for the house of Israel. As una dey go, make una preach sey: ‘The Kingdom wey dey heaven don near.’”—Matthew 10:5-7.

Na which Kingdom dem go preach about? Na the one wey Jesus talk about when e teach people how to pray. When Jesus sey ‘the Kingdom don near,’ wetin e mean? E mean sey Jesus Christ wey go be King of that Kingdom dey with dem. But how the disciples go take show sey dem dey work for this Kingdom? Jesus give dem power to cure sick people and even bring people wey don die back to life. And e go be free. But how the apostles go take get things like food, wey dem need?

Jesus tell im disciples make dem no prepare things wey dem go carry as dem dey go preach. E sey make dem no carry gold, silver, or copper for their purse. Dem no even need to carry bag wey dem go put food, or extra cloth or sandals. Why? Jesus promise dem sey who dey work must chop. (Matthew 10:10) The people wey like the message go give the disciples wetin dem really need. Jesus still sey: “Any house wey una enter, make una stay there until una comot for the place.”—Mark 6:10.

How the disciples go take preach the message about the Kingdom to people? Jesus tell dem sey: “When una enter any house, greet the people wey dey there. If the people ready to listen, make the peace wey una carry come, dey with dem. But if dem no want to listen, make the peace wey una carry come, return to una. Anywhere wey dem no welcome una or listen to una, as una dey comot from that house or town, make una shake the dust comot from una leg.”—Matthew 10:12-14.

E fit even be sey one full town or village go reject the message. Wetin go happen to that place? Jesus talk wetin show sey dem go get heavy judgment. E sey: “True true, I dey tell una sey e go dey more easy for Sodom and Gomorrah for Judgment Day pass that city.”—Matthew 10:15.

  • Which time Jesus start to preach round Galilee again, and how e talk sey the people condition be?

  • How Jesus take send the 12 apostles go preach, and wetin e tell dem?

  • Wetin Jesus mean when e sey ‘the Kingdom don near’?

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share