Where We Fit Get Answer to Many Many Question Wey Dey Worry Us for Mind?
Na for . . .
inside big big book?
wetin old people talk?
Bible?
ONE OF THE PERSON WEY FOLLOW WRITE BIBLE TELL GOD SEY
Help me understand your word because everything wey you talk na true.’—Psalm 119:144, 160, New World Translation.
Many many people dey find the answer for inside Bible.
You go like make Bible answer your question?
Our Web site wey be jw.org go help you.
READ wetin dey internet
Bible dey for different different language wey pass 100
Answer to many question about Bible
Help for your family
WATCH different different video wey talk about Bible
Bible story and song for pikin dem
Advise for young people
How people take show sey dem get faith
DOWNLOAD different different book
The brochure Good News Wey Come From God!
The magazine Watchtower and Awake!
WHICH QUESTION FOR HERE DEY WORRY YOUR MIND PASS?
Why God make us?
We go blame God because we dey suffer?
Wetin dey happen when we die?
See how Bible take answer this question dem for jw.org.
(Make you press WETIN BIBLE DEY TEACH > HOW BIBLE TAKE ANSWER)