CHAPTER FOUR
Who Jesus Christ Be?
1, 2. (a) If you know only the name of person wey people know well well, you go fit talk sey you really know the person? Explain. (b) Wetin some people believe about Jesus?
E GET some people wey dem know well well for the whole world. You fit even know some of their name. But because sey you know their name no mean sey you know dem finish. E no mean sey you don know everything about dem and the kind person wey dem be.
2 You fit don hear about Jesus, even though sey e don reach 2,000 years since e live for this earth. No be everybody know the kind person wey Jesus be. Some people talk sey Jesus na one good man, some sey na prophet, and some believe sey Jesus na God. Wetin you think?—Check Endnote 12.
3. Why e good make you learn about Jehovah and Jesus?
3 Why e good make you know the truth about Jesus? Bible talk sey: ‘Dem go get life wey no go end, if dem know you wey be the only true God, and know the person wey you send come this world, Jesus Christ.’ (John 17:3) The truth be sey, if you know the truth about Jehovah and Jesus you go get life wey no go end for paradise. (John 14:6) You go still gain other things if you know about Jesus, because you fit follow im example if you want learn how to live better life and how to treat other people well. (John 13:34, 35) For Chapter 1, we don learn the truth about God. We want come learn wetin Bible teach us about Jesus.
WE DON SEE THE MESSIAH!
4. Wetin “Messiah” and “Christ” mean?
4 Many years before dem born Jesus for this earth, Jehovah don talk am for Bible sey e go send Messiah or Christ come. “Messiah” na Hebrew word and “Christ” na Greek word. The two word mean the same thing. E mean special person wey God don choose with im holy spirit to be King. Na the Messiah go make everything wey God don promise happen. E fit still help us now. Before dem born Jesus, people go don dey ask theirself sey, ‘Who go be the Messiah?’
5. Wetin show sey Jesus disciple believe sey na Jesus be the Messiah?
5 Jesus disciple know and dey sure sey na Jesus be the Messiah. (John 1:41) For example, Simon Peter tell Jesus sey: ‘Na you be the Christ.’ (Matthew 16:16) Wetin go help us dey sure sey na Jesus be the Messiah?
6. How Jehovah take help people wey get better mind know sey na Jesus be the Messiah?
6 God prophet dem write many things wey go help people know who the Messiah go be. And e don tey wey dem write am before Jesus come this earth. How this one fit help us? Think am sey dem send you go motor park make you go bring person wey you never see before. Na only if dem tell you things wey go help you sabi how the person be, you go fit know am. Na so Jehovah take help us. E use im prophet dem take tell us wetin the Messiah go do and wetin go happen to am. People wey get better mind to learn, know sey na Jesus be the Messiah because all the things wey the prophet dem talk about the Messiah, happen to Jesus.
7. Wetin be the two things wey the prophet dem talk wey show sey na Jesus be the Messiah?
7 See two things wey the prophet dem talk. (1) 700 years before dem born Jesus, prophet Micah talk sey na for Bethlehem wey be one small town dem go born the Messiah. (Micah 5:2) And na there dem born Jesus! (Matthew 2:1, 3-9) (2) Prophet Daniel talk sey na the year 29 C.E. the person go come be Messiah. (Daniel 9:25) This one na only two for inside the plenty things wey dem talk about the Messiah. And e show sey na Jesus really be the Messiah.—Check Endnote 13.
Na when Jesus baptize e become Messiah or Christ
8, 9. When Jesus baptize, wetin happen wey show sey na im be the Messiah?
8 Wetin Jehovah don do show sey na Jesus be the Messiah. God promise John the Baptist sey e go show am who the Messiah be. For the year 29 C.E., Jesus come go meet John make e baptize am for River Jordan, na that time John take see wetin Jehovah tell am sey go happen to the person wey be the Messiah. Bible tell us wetin happen, ‘After dem baptize am finish, Jesus come out from the water; see o! Heaven open, and e see God spirit wey be like dove, dey come down on top am. See! One voice from heaven talk sey: Na my Son be this, wey I choose. I like am well well.’ (Matthew 3:16, 17) When John see and hear wetin God talk, e come know sey na Jesus be the Messiah. (John 1:32-34) Na that day wey God holy spirit come on top Jesus e become Messiah. Na im God don choose to be Leader and King.—Isaiah 55:4.
9 The things wey the prophet dem talk for inside Bible sey go happen, the things wey Jehovah talk by imself and wetin happen when Jesus dey baptize, show sey na Jesus be the Messiah. But where Jesus come from, and which kind person e be? Make we see the answer for Bible.
WHERE JESUS DEY BEFORE E COME THIS EARTH?
10. Wetin Bible talk about Jesus before e come this earth?
10 Bible talk sey e don tey wey Jesus dey stay for heaven before e come earth. Prophet Micah talk sey the Messiah ‘don dey tey tey.’ (Micah 5:2) Many times, Jesus talk am with im own mouth sey e first dey stay for heaven before dem born am as human being. (Read John 3:13; 6:38, 62; 17:4, 5.) Before Jesus come this earth, im and im Father na tight friend.
11. Why Jesus dey special to Jehovah well well?
11 Jesus dey special to Jehovah well well. Why? Because na im Jehovah make before anything and anybody. Na im make dem dey call Jesus ‘the first person for everything wey God make.’a (Colossians 1:15) Another thing wey make Jesus dey special to Jehovah na because Jesus na the only person wey Jehovah use im own hand make. Na this one make Bible call am God ‘only special Son.’ (John 3:16) Another thing be sey, na Jesus be the only person wey Jehovah use make other things. (Colossians 1:16) Na only Jesus be ‘the Word,’ because na im Jehovah use give im message and law to angels and human being.—John 1:14.
12. How we take know sey Jesus no be God?
12 Some people believe sey na Jesus be God. But that one no be wetin Bible teach us. Bible talk sey na Jehovah make Jesus, that one mean sey Jesus get beginning. But Jehovah wey make everything no get beginning. (Psalm 90:2) Jesus na God Son, and e no ever think am for im mind sey e want be God. Wetin Bible teach dey clear, wetin e teach be sey the Father high pass the Son. (Read John 14:28; 1 Corinthians 11:3.) Na only Jehovah be ‘God Almighty.’ (Genesis 17:1) Na im high pass and na im get power pass for heaven and earth.—Check Endnote 14.
13. Why Bible talk sey Jesus ‘resemble the God wey dem no fit see’?
13 Many many years before Jehovah make heaven and earth, im and Jesus work together. Dem love theirself well well. (John 3:35; 14:31) Jesus copy im Father well well, na im make Bible talk sey e ‘resemble God wey dem no fit see.’—Colossians 1:15.
14. How dem take born Jesus for this world?
14 Jesus ready to comot for heaven and come this earth as human being. How that kind thing take happen? Jehovah do miracle, e carry im Son life comot from heaven, come put am inside one woman belle. The woman name na Mary, e never sabi man before. As Jehovah do this miracle, e mean sey Mary no need to sleep with man before e get the belle. So the pikin no get sin. Im name na Jesus.—Luke 1:30-35.
WHICH KIND PERSON JESUS BE?
15. How you fit take know more about Jehovah?
15 If you read the Bible book of Matthew, Mark, Luke, and John you go learn plenty things about Jesus, im life and the kind character wey e get. Dem dey call this four book the Gospels. If you read about Jesus for Bible, you go know Jehovah more more because e be like im Father. Na im make Jesus talk sey ‘anybody wey see me don see my Father.’—John 14:9.
16. Wetin Jesus teach people? Who get the message wey Jesus teach?
16 Na “Teacher” many people dey call Jesus. (John 1:38; 13:13) One of the things wey e teach wey better pass na ‘the good news about God Kingdom.’ Wetin be God Kingdom? Na God government wey go rule from heaven. E go rule the whole earth, and God go use am bless all the people wey do wetin e talk. (Matthew 4:23) Everything wey Jesus teach na from Jehovah, na im make Jesus talk sey: ‘Wetin I dey teach no be my own, but na the person wey send me get am.’ (John 7:16) Jesus know sey Jehovah want make people hear the good news. And this good news na about how God Kingdom go take rule the whole earth.
17. Where Jesus for teach people? Wetin make Jesus try well well to teach people the good news?
17 Where Jesus for teach people? E teach people for anywhere wey e see dem. E teach people for farm, inside town, village, market, inside temple and for their house. E no wait make people come meet am, na im dey go meet dem. (Mark 6:56; Luke 19:5, 6) Jesus try well well, e use im time and power teach people. Why Jesus do like that? Na because e know wetin Jehovah want make e do and because e dey always do wetin im Father send am. (John 8:28, 29) Another thing wey make Jesus preach be sey, e dey pity for people. (Read Matthew 9:35, 36.) Jesus see am sey the other people wey dey teach people, no dey teach dem the truth about God and im Kingdom. So wetin dey im mind na to help many people hear the good news.
18. Which character Jesus get wey you like well well?
18 Jesus na person wey love people well well and e dey help dem. E get good mind and e dey easy to follow am talk. Even small small pikin like to dey with am. (Mark 10:13-16) Jesus dey treat people well, e no like partial and e hate wayo. (Matthew 21:12, 13) Jesus live for the time wey people no value women. But Jesus value women and e treat dem well. (John 4:9, 27) Jesus no ever carry shoulder up, for example, e get one evening wey e wash all im apostle leg. Na slave work be that.—John 13:2-5, 12-17.
Jesus preach for anywhere wey e see people
19. Give example wey show sey Jesus know wetin people really need and e ready to help dem?
19 True true, Jesus know wetin people really need, and wetin e get for mind na to help dem. Jesus show sey na to help people dey im mind when e use the power wey God give am heal people wey dey sick. (Matthew 14:14) For example, e get the time wey one man wey get leprosy tell Jesus sey: ‘If you want, you fit make me clean.’ Jesus pity the man because of im pain and as e dey suffer. Na to help the man come dey im mind because e dey pity for am. Jesus touch am, come talk sey: ‘I want! Make you dey clean.’ Na quick quick the leprosy take comot for im body! (Mark 1:40-42) How you think sey the man go feel?
JESUS DEY ALWAYS DO WETIN IM FATHER TALK
20, 21. How Jesus take be the best example of person wey do wetin God want?
20 If you want learn how to do wetin God talk, na Jesus example better pass to follow. No matter wetin happen or wetin people do am, e no stop to dey do wetin im Father want. For example, Jesus no do wetin Satan talk when Satan try am. (Matthew 4:1-11) Some people for Jesus family no believe sey na im be the Messiah. Dem even talk sey ‘e don dey craze,’ e no let that one shake am, but e continue to dey do God work. (Mark 3:21) When im enemy dem dey do am bad, e no stop to dey serve God and e no even try to do dem back.—1 Peter 2:21-23.
21 Before Jesus die, e suffer well well, but no matter how e suffer reach e still hold Jehovah tight. (Read Philippians 2:8.) Think about the pain wey e bear the day wey e die. Dem arrest am, lie for im head sey e dey lie about God, wayo judge sey make dem kill am, plenty people laugh am, soldiers show am pepper come nail am for pole. As e dey die, e come talk sey: ‘E don finish!’ (John 19:30) After three days wey e die, Jehovah bring am come back to life, e come make am spirit. (1 Peter 3:18) After some weeks e come go back to heaven, go ‘sit down for God right hand,’ e come wait until God make am King.—Hebrews 10:12, 13.
22. Which hope we get as Jesus no stop to dey do wetin im Father want?
22 We get hope sey we go live forever for paradise wey go come this earth as Jehovah get am for mind. This na because Jesus no stop to dey do wetin im Father want. For the next chapter, we go talk about how Jesus death fit make us live forever.
a Jehovah still be our Father because na im make everything. (Isaiah 64:8) Jesus na God Son because na Jehovah make am. All the angel for heaven and even Adam na still God son.—Job 1:6; Luke 3:38.