CHAPTER TEN
Wetin Bible Teach Us About Angels?
1. Why e good make we learn about angels?
JEHOVAH want make we know im family. Angels na part of im family. Bible call dem “sons of God.” (Job 38:7) Wetin be their work? Wetin dem don do for people before? Dem still dey help us now?—Check Endnote 8.
2. Who make all the angels? How the angels many reach?
2 E good make we know who make the angels. Colossians 1:16 tell us sey after Jehovah make Jesus, e make angels and other things for heaven and this earth. How the angels many reach? Bible talk sey angels wey dey heaven plenty no be small.—Psalm 103:20; Revelation 5:11.
3. Wetin Job 38:4-7 tell us about angels?
3 Bible still talk sey Jehovah make all the angels before e make this earth. How e do angels for body when God make this earth? The Bible book of Job talk sey all of dem happy. All the angels na one family wey dey serve Jehovah.—Job 38:4-7.
ANGELS DEY HELP GOD PEOPLE
4. How we take know sey angels like human being?
4 E don tey wey angels like human being and dem really want know wetin Jehovah get for mind to do for this earth. (Proverbs 8:30, 31; 1 Peter 1:11, 12) E pain dem that time wey Adam and Eve sin. E dey pain dem well well now when dem see sey many people no gree do wetin Jehovah want. But when person repent and start to serve God again, angels dey happy. (Luke 15:10) Angels like people wey dey serve Jehovah. Jehovah dey use angels help and protect people wey dey serve am for this earth. (Hebrews 1:7, 14) Make we see some example.
My God send im angel come close the mouth of all the lion.—Daniel 6:22
5. How angels take help God people before our time?
5 When Jehovah want destroy Sodom and Gomorrah, e send two angels make dem go help Lot and im family run comot. (Genesis 19:15, 16) After many years, dem throw Daniel inside pit wey lion full, but nothing do am, because God send im angel to close the mouth of all the lion. (Daniel 6:22) Later, when apostle Peter dey prison, Jehovah send im angel go release am. (Acts 12:6-11) Angels still help Jesus when e dey this earth. For example, dem help am after e baptize. (Mark 1:13) Before dem arrest Jesus, angels help am get strong mind—Luke 22:43.
6. (a) How we take know sey angels dey help God people today? (b) Which question we go answer?
6 Angels no dey appear to human being again, but God still dey use dem to help im servant. Bible help us know sey Jehovah dey use im angels protect people wey dey fear am (Psalm 34:7) Why we need God to protect us? Na because we get many enemy wey dey cause problem for us. Who dem be? Where dem come from? How dem take dey cause problem for us? Make we see wetin happen after God make Adam and Eve. That one go help us answer all this question.
ANGELS WEY BE OUR ENEMY
7. Wetin Satan dey do?
7 For Chapter 3 we learn sey one angel stop to dey do wetin God talk because e want rule other people. Bible call am Devil and Satan. (Revelation 12:9) Wetin dey Satan mind na to draw people comot from God side. E deceive Eve, and since that time, e don dey deceive many people. But some people like Abel, Enoch, and Noah no stop to dey serve Jehovah.—Hebrews 11:4, 5, 7.
8. (a) How some angels take become demons? (b) Wetin the demons do make dem for no die?
8 For Noah time, some angels stop to dey do wetin Jehovah want, dem comot from heaven come dey stay this earth as human being. Why? Bible talk sey na because dem want marry women. (Read Genesis 6:2.) But angels no suppose do that kind thing. (Jude 6) Many people that time come dey fight anyhow and na so so bad thing full their mind. Jehovah come use heavy rain destroy all the wicked people for the whole earth. But e save people wey dey serve am. (Genesis 7:17, 23) Because the angels no want die, dem go back to heaven. Bible call those wicked angels demons. Satan come dey rule all the angels wey join am for im bad way.—Matthew 9:34.
9. (a) Wetin happen to the demons when dem reach heaven? (b) And wetin be the next thing wey we go learn?
9 As this angels no gree do wetin Jehovah want, when dem reach heaven, Jehovah no let dem join im family again. (2 Peter 2:4) Demons no fit change to human being again, but dem still dey deceive people for this earth. (Revelation 12:9; 1 John 5:19) Make we learn how dem take dey deceive many people.—Read 2 Corinthians 2:11.
HOW DEMONS TRICK PEOPLE
10. How demons take dey deceive people?
10 Demons get different different way wey dem take dey deceive people. Some people dey talk to demons direct and some dey go meet people wey dey fit talk to dem, like native doctor or juju priest. Anything wey get hand for demon matter na demonism or Spiritism. Bible don warn us sey make we no put hand for anything wey concern demons. (Galatians 5:19-21) Why? Because, demons dey use am catch people the way hunter dey use trap catch animal.—Check Endnote 26.
11. Wetin people dey do to tell other people wetin go happen for future and why we suppose run from that kind thing?
11 One way wey demons take dey deceive people na to tell dem wetin go happen for front. Na demon power people take dey know wetin go happen for front, no be ordinary hand. Some dey use star know wetin go happen for front, some go look person hand or im face to know wetin go happen to the person for future. Many people think sey this kind thing no bad at all, but na big lie! The truth be sey, e dey put person for trouble. For example, Bible show sey people wey dey talk wetin go happen for people life dey follow demon waka. Acts 16:16-18, talk about one girl wey dey use demon power tell people wetin go happen to dem for future. After Paul pursue the demon comot from the girl body, the girl no come fit dey do am again.
12. (a) Why e bad to dey try talk to person wey don die? (b) Why Jehovah people no dey put hand for any tradition wey demon dey control?
12 E get another way demons take dey deceive people. Dem dey try to make us believe sey we fit talk to people wey don die. Dem still sey people wey don die never really die, dem fit talk to us and dem fit do us bad things. For example, person wey one of im family member die fit go meet native doctor because e want talk to the person wey die. The native doctor fit tell am wetin e want hear about the family member wey don die, e fit even talk like the person wey don die. (1 Samuel 28:3-19) For some area, if person die, dem dey do wake keeping, dey do sacrifice for the dead body, and dey do second burial. Dem still dey tell person wey im husband or wife die, make e do some things. Dem dey do all this things because dem believe sey person wey don die, never really die. E still dey live for another place. If person wey dey serve Jehovah no gree join dem do this things, im family and village people fit start to talk bad things about am, curse am or even stop to do things with am. But Jehovah people no go join dem because we know sey person wey don die, don die. We no fit talk to dem, and dem no fit do us anything. (Psalm 115:17) No ever try to follow demon or person wey don die talk. All this kind thing na wetin demon take dey control people. Abeg no do am.—Read Deuteronomy 18:10, 11; Isaiah 8:19.
13. Wetin many people wey dey fear demons before don stop to dey do?
13 Demon no dey only deceive people, dem still dey do wetin go make people fear. For this our time, Satan and im demons know sey ‘na small time remain’ for dem, dem know sey God go soon destroy dem, na im make dem dey vex, and dey cause wahala for people. (Revelation 12:12, 17) But many people wey dey fear demons before don stop to dey fear dem. How dem take do am?
NO LET DEMONS CONTROL YOU
14. Like Christians for Ephesus, wetin we go do if we no want make demons dey control us?
14 Bible tell us wetin we go do if we no want make demons dey control us. For example, some people wey dey live for Ephesus dey talk to demons, but dem stop to dey do that kind thing after dem study Bible. How dem take free theirself? Bible talk sey: ‘Many of the people wey dey do magic come gather their book together, dem burn am for everybody front.’ (Acts 19:19) Dem burn all the book wey dem dey use learn magic because dem want be Christian. Na so we self suppose do. Anybody wey want serve Jehovah no suppose get anything wey concern demon matter, e suppose destroy am. E fit be book, magazine, film, drama, music, game, poster or anything wey dey make people like things wey concern demons. Things wey people dey wear make bad thing no happen to dem na still part of wetin demons take dey control people.—1 Corinthians 10:21.
15. Wetin we still need to do if we no want make Satan and im demons dey control us?
15 Some years after the Christians for Ephesus burn their juju book, apostle Paul talk sey dem still dey struggle dey fight wicked spirit. (Ephesians 6:12) Even though sey dem don already burn all their book, the demons still dey try to do dem bad. So, wetin dem still need to do? Paul tell dem sey: ‘Carry the big shield of faith wey una go take block the wicked person arrow wey dey burn.’ (Ephesians 6:16) Just like shield dey protect soldier for war, our faith go protect us. If we really get faith sey Jehovah go protect us, we go fight Satan and im demons.—Matthew 17:20.
16. How we go take make our faith for Jehovah strong well well?
16 How we go take make our faith for Jehovah strong well well? We need to dey read Bible everyday and dey trust Jehovah sey e go protect us. If we really trust Jehovah, Satan and im demons no go fit do us anything.—1 John 5:5.
17. Wetin be another thing wey fit protect us from demons?
17 Wetin the Christians for Ephesus still need to do? For the city wey dem dey stay, people dey worship demons well well. So Paul tell dem sey make dem dey pray everytime. (Ephesians 6:18) Dem need to dey beg Jehovah make e dey protect dem everytime. What about us? As we dey live for this world wey people dey worship demons, we need to dey beg Jehovah sey make e dey protect us. We still need to use im name when we dey pray. (Read Proverbs 18:10.) Jehovah go answer our prayer, if we no stop to beg am make e free us from Satan hand.—Psalm 145:19; Matthew 6:13.
18, 19. (a) How we fit win our fight with Satan and im demons? (b) Which question we go answer for the next chapter?
18 If we destroy anything wey concern demons and trust Jehovah sey e go protect us, we go free from Satan and im demons. We no need to dey fear dem. (Read James 4:7, 8.) Jehovah get power pass demons by far. E punish dem for Noah time, and e go destroy dem for future. (Jude 6) Remember sey Jehovah dey use im angels protect us, so we no dey fight Satan alone. (2 Kings 6:15-17) We dey sure sey Jehovah go help us win Satan and im demons.—1 Peter 5:6, 7; 2 Peter 2:9.
19 But why God never destroy Satan and im demons as dem dey make us suffer? We go answer this question for the next chapter.