Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • bhs chap. 15 pp. 154-163
  • The Correct Way to Serve God

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • The Correct Way to Serve God
  • Wetin Bible Dey Teach Us?
  • Small Topic Dem
  • Similar Material
  • THE CORRECT WAY TO SERVE GOD
  • WETIN YOU GO COME DO?
  • How You Fit Know the Correct Way to Serve God?
    Good News Wey Come From God!
Wetin Bible Dey Teach Us?
bhs chap. 15 pp. 154-163

CHAPTER FIFTEEN

The Correct Way to Serve God

1. Who go fit tell us the correct way to serve God?

MANY religion today dey claim sey na dem dey teach the truth about God. But na true? For where! All of dem no fit teach the truth about God, when dem dey teach different things about who God be, and how we go take serve am. So how we go take know the correct way to serve God? The truth be sey na only Jehovah go fit tell us the correct way to serve am.

2. How you go take know the correct way to serve God?

2 Jehovah give us Bible so that we go fit know the correct way to serve am. So e good make you dey study Bible, and Jehovah go help you understand wetin Bible dey teach, because e love you well well.—Isaiah 48:17.

3. Wetin God want make we know and do?

3 Some people dey talk sey “e no matter, na the same God all of us dey serve,” but no be wetin Jesus talk be that. E talk sey: ‘No be everybody wey dey call me, “Lord, Lord,” go enter the Kingdom wey dey for heaven. Na only people wey dey do wetin my Father wey dey for heaven want, go enter.’ This one mean sey e good make we know wetin God want and dey do am. This matter serious because, Jesus talk sey people wey no dey follow God way be like people wey no dey follow law, and ‘dey do bad things.’—Matthew 7:21-23.

4. Wetin Jesus talk about the two road?

4 Jesus talk sey we go face wahala when we want do wetin God want. E talk sey: ‘Make una pass the gate wey no wide. Because the gate wey big and the road wey wide na im dey carry people go where dem go destroy, and na many people dey follow the road; but the gate wey no wide, and the road wey tight dey carry people go where dem go get life, but people wey dey follow the road no plenty.’ (Matthew 7:13, 14) This place show sey na the road wey tight be the correct way to serve God and people wey dey follow am, go get life wey no go end. The road wey wide no be the correct way to serve God and the people wey dey follow that road no go get life, dem go die. But Jehovah no want make anybody die, na im make e dey give everybody the chance to learn about am.—2 Peter 3:9.

THE CORRECT WAY TO SERVE GOD

5. How we go take know the people wey dey serve God the correct way?

5 We go fit know the people wey dey serve God the correct way? Yes! Jesus tell us how we go take know dem. We go know dem if we dey look wetin dem dey do and how dem take dey behave. Jesus talk sey: ‘Na wetin dem dey do una go take sabi dem.’ E still talk sey: ‘Good tree dey bear fine fruit.’ (Matthew 7:16, 17) This one no mean sey people wey dey serve God the right way no dey make mistake. But people wey really dey serve God dey always try to do good things. Make we see things wey go help us know the people wey dey serve God the right way.

6, 7. Why e be sey na Bible go fit tell us the correct way to serve God? Wetin Jesus example teach us?

6 People wey dey serve God the correct way must worship God the way Bible talk. Bible talk sey: ‘Na God spirit dem take write wetin dey inside Bible. You fit use am teach the truth, show people their mistake, correct mistake and show person how e go take live the kind life wey God want. So that person wey dey serve God go fit ready well and get everything wey e need to take do good things. (2 Timothy 3:16, 17) Apostle Paul tell Christians sey: ‘When una hear God Word wey we tell una, una no see am like sey na our word but una believe am as e really be sey na God word.’ (1 Thessalonians 2:13) Everything wey people wey dey serve God the correct way believe na from Bible, dem no dey follow wetin people think, wetin people believe or any other thing.

7 Everything wey Jesus teach people na from God Word. (Read John 17:17.) E dey even quote wetin dey inside God Word. (Matthew 4:4, 7, 10) So people wey dey really serve God dey follow Jesus example to make sure sey everything wey dem dey teach na from Bible.

8. Wetin Jesus talk wey show sey na only Jehovah we must serve?

8 People wey dey serve God the correct way dey worship only Jehovah. Psalm 83:18 talk sey: ‘You, wey your name na Jehovah, na only you High Pass for the whole world.’ Jesus really want make people know who God be, na im make am teach dem God name. (Read John 17:6.) Jesus talk sey na Jehovah your God you must worship, and na only am you go serve. (Matthew 4:10) So people wey dey serve God the correct way dey follow Jesus example. Dem dey worship only Jehovah, dem dey use im name, and dem still dey teach other people God name and wetin e get for mind to do for us.

9, 10. How people wey dey serve God the correct way take dey show love?

9 Their love no be for mouth. Jesus tell im disciples sey make dem love each other. (Read John 13:35.) E no matter where dem come from, or who dem be, whether dem rich or poor. The love wey dem get for theirself dey make dem serve God together with one mind as brothers and sisters. (Colossians 3:14) Dem no dey fight war or kill people. Bible talk sey: ‘Na like this una go take know sey God pikin and Devil pikin dey different; anybody wey no dey do good thing and wey no love im brother, no be God pikin.’ E still talk sey: ‘Make we love ourself; make we no be like Cain, wey be Devil pikin wey kill im brother.’—1 John 3:10-12; 4:20, 21.

10 Dem dey use their time, power and wetin dem get help other people. (Hebrews 10:24, 25) In short, dem dey ‘do good for everybody.’—Galatians 6:10.

11. Why e be sey people wey dey serve God the correct way dey obey Jesus?

11 People wey dey serve God the correct way dey obey Jesus because na im be the way to God. Bible tell us sey: ‘Another person no dey wey go fit save us, e no get any other name for this earth wey people dey bear wey fit save us.’ (Acts 4:12) We learn am for Chapter 5 of this book sey Jehovah send Jesus come this earth to die for people wey dey obey God and to save dem. (Matthew 20:28) Jehovah don choose Jesus as King wey go rule this earth. Na im make Bible tell us sey we must obey Jesus if we want live forever.—Read John 3:36.

12. Why people wey dey serve God the correct way no dey put hand for politics?

12 People wey dey serve God the correct way no dey put hand for politics. Jesus no put hand for politics or this world matter. When dem arrest am, e tell Pilate wey be governor sey: ‘My Kingdom no be from this world.’ (Read John 18:36.) So people wey dey serve God the correct way be like Jesus, na only God Kingdom dem dey support. So no matter where dem dey, dem no dey ever put hand for politics matter. But Bible tell us sey make we dey obey government. (Romans 13:1) So people wey dey serve God the correct way dey obey the law of the country wey dem dey stay. But if the law no gree with wetin God talk, dem dey do like Jesus apostles wey talk sey: ‘Na God we go obey as ruler, no be people.’—Acts 5:29; Mark 12:17.

13. Wetin people wey dey serve God the correct way dey tell other people about God Kingdom?

13 People wey dey serve God the correct way believe sey na only God Kingdom go fit comot all the wahala wey dey this world. Jesus talk sey people go dey preach ‘good news about God Kingdom’ for everywhere for this world. (Read Matthew 24:14.) No human being government go fit do wetin God Kingdom go do for us. (Psalm 146:3) Jesus teach us to dey pray about God Kingdom when e talk sey: ‘Make your kingdom come. Make wetin you get for mind for this earth happen as e dey happen for heaven.’ (Matthew 6:10) Bible tell us sey God Kingdom go destroy all human being own and only am ‘go stand forever.’—Daniel 2:44.

14. Which people you believe sey dey serve God the correct way?

14 As you don learn all this things wey go help you know the people wey dey serve God the correct way, ask yourself sey: ‘Which people dey teach wetin dey Bible? Which people dey tell other people God name? Which people dey really show sey dem love theirself and believe sey na God send Jesus to come save us? Which people no dey put hand for politics matter? Which people dey preach sey na only God Kingdom go fit solve all our problem?’ Na only Jehovah Witness people dey do all this things.—Isaiah 43:10-12.

WETIN YOU GO COME DO?

15. Wetin we go do if we want serve God the way e like?

15 To believe sey God dey no reach. Demons believe sey God dey, but dem no dey obey am. (James 2:19) If we want serve God the way e like, we must believe sey God dey and we go dey do wetin e sey make we do.

16. Why e good make we comot from religion wey no dey follow God way?

16 If we want make God like the way we dey serve am, we must comot from religion wey no dey follow im way. Prophet Isaiah talk sey make we comot from religion wey God hate. (Isaiah 52:11; 2 Corinthians 6:17) This one show sey we need to comot hand from anything wey concern fake religion.

17, 18. Wetin be the meaning of ‘Babylon the great,’ and why e good make you quick comot for there?

17 Wetin be fake religion? Fake religion na any religion wey no dey teach people to serve God the way e want. Bible call am ‘Babylon the Great.’ (Revelation 17:5) Why Bible call am this name? After the heavy rain wey fall for Noah time, plenty fake religion start for Babylon. And before you know, the things wey dem dey teach come spread full everywhere. For example, the people for Babylon dey worship different different god wey be three in one. And many church today still dey teach sey God na three in one. But no be so Bible talk. Bible tell us sey we get only one true God and im name na Jehovah, the name of im son na Jesus. (John 17:3) People for Babylon still believe sey person wey don die dey live for another place or e fit dey suffer for hell fire. But that na big lie.—Check Endnote 14, 17, and 18.

18 Bible tell us sey God go soon destroy all fake religion. (Revelation 18:8) So you know why e good make you quick comot for fake religion? Na because Jehovah go soon destroy all of dem. And e no want make you die.—Revelation 18:4.

Jehovah Witness people dey happy to welcome one man wey don make up im mind to serve Jehovah

If you serve Jehovah, you go come dey among Jehovah people wey be one big family where everybody love each other well well

19. Wetin Jehovah go do for you if you choose to serve am?

19 When you comot for fake religion and you come dey serve Jehovah, some of your family people and your friends fit no understand wetin you dey do. Dem fit even start to dey cause wahala for you. But no fear, Jehovah no go leave you. You go come dey among Jehovah people wey be one big family where everybody love each other well well, and you go get the hope to stay for paradise forever. (Mark 10:28-30) Some of those people wey dey cause trouble for you before fit come even join you dey serve Jehovah.

20. Why e good make you serve God the way e want?

20 Jehovah go soon destroy all bad people and bring im Kingdom come this earth. (2 Peter 3:9, 13) That time go really make sense no be small! Everybody go dey serve Jehovah the way e want make we serve am. You no see am sey na better thing for you to serve God the way e want now?

HOW TO KNOW PEOPLE WEY DEY SERVE GOD THE CORRECT WAY

People wey come from different different place, wey their age different, no matter who dem be dey serve Jehovah together the way e want
  • everything wey dem dey teach na from Bible

  • dem dey serve only Jehovah and dey teach other people about im name

  • dem love theirself well well

  • dem believe sey God send Jesus to come save us

  • dem no dey put hand for politics matter

  • dem dey preach sey na only God Kingdom go fit comot all the wahala wey dey this world

WETIN WE LEARN

TRUTH 1: HOW TO KNOW THE CORRECT WAY TO SERVE GOD

‘The gate wey no wide, and the road wey tight dey carry people go where dem go get life, but people wey dey follow the road no plenty.’​—Matthew 7:14

How we take know sey no be all religion God like?

  • Matthew 7:21-23

    No be all religion God like. No be all dey do wetin e want.

  • Matthew 7:13, 14

    Serve God for the correct way, and get life wey no go end. God go destroy people wey no dey serve am the correct way.

  • Matthew 7:16, 17

    You fit know the correct way to serve God. You no need to study all the religion wey dey this world. You go know am if you study Bible.

TRUTH 2: THE CORRECT WAY TO SERVE GOD

  • 1 Thessalonians 2:13; 2 Timothy 3:16, 17

    Believe and teach people wetin dey Bible.

  • Matthew 4:10; John 17:6

    Worship Jehovah and dey use im name.

  • John 13:35

    Dey show love.

  • John 3:36; Acts 4:12

    Obey Jesus. God use Jesus save us.

  • John 18:36; Acts 5:29

    No dey put hand for politics matter.

  • Matthew 24:14; 6:10

    Teach people sey na only God Kingdom fit solve all our problem.

TRUTH 3: DEY DO WETIN BIBLE TALK

Wetin you go do if you want serve God the correct way?

  • James 2:19

    You must believe sey God dey and dey do wetin e sey make you do.

  • Isaiah 52:11; Revelation 17:5

    Fake religion wey be ‘Babylon the Great’ no dey teach people to serve God the way e want. Dem dey teach people sey God na three in one, and sey if person die, e dey go another place or e fit go hell fire.

  • Revelation 18:4, 8

    Jehovah go soon destroy all fake religion. So no put hand for anything wey concern fake religion.

  • Mark 10:28-30

    People fit cause trouble for you If you make up your mind to serve Jehovah, but Jehovah no go ever leave you.

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share