CHAPTER EIGHTEEN
Promise Jehovah Sey You Go Serve Am And Make You Baptize
1. Wetin fit come your mind after you don dey study this book?
YOU don learn many truth from Bible since you start to dey study this book. You learn sey God promise us life wey no go end. You learn wetin dey happen to person wey die, and you still learn sey God promise to bring people wey don die come back to life. (Ecclesiastes 9:5; Luke 23:43; John 5:28, 29; Revelation 21:3, 4) You fit don dey go Jehovah Witness Kingdom Hall and believe sey na dem dey serve God the correct way. (John 13:35) You fit don near Jehovah pass before, and you fit don make up your mind sey you want serve am. But you fit dey ask yourself sey: ‘If I want serve God now, wetin I go do?’
2. Wetin make the Ethiopia man want baptize?
2 For the apostles time, e get one man from Ethiopia wey ask this kind question. After Jesus don go back to heaven, one of im disciple wey dem dey call Philip preach to the man. Philip help the man see sey na Jesus Christ be the Messiah. Wetin Philip teach the man really enter im mind. When dem come reach where water dey, e come tell Philip sey: ‘See water! Wetin dey hold me make I no baptize?’—Acts 8:26-36.
3. (a) Wetin Jesus tell im disciples? (b) Wetin be the correct way to baptize?
3 Bible help us know sey if we want serve Jehovah, we need to baptize. Jesus tell people wey dey follow am sey: ‘Make una go make people my disciple for the whole world, and baptize dem.’ (Matthew 28:19) Jesus self baptize. When Jesus dey baptize, all im body enter inside water, dem no just pour water for im head. (Matthew 3:16) As people wey dey follow Jesus example, all our body need to enter inside water when we dey baptize.
4. Wetin people go know when you baptize?
4 When you baptize, e go make other people know sey you don ready to be God friend and sey you want serve am. (Psalm 40:7, 8)But you fit ask sey, ‘Wetin I go do so that I go baptize?’
WETIN YOU NEED BEFORE YOU BAPTIZE
5. (a) Wetin you need to do before you baptize? (b) Why e good make you dey go Jehovah Witness meeting?
5 You need to know who Jehovah and Jesus really be before you baptize. You don already start to dey learn about dem as you dey study Bible. (Read John 17:3.) But e never finish o, Bible help us know sey we need to know the truth about Jehovah well. (Colossians 1:9) Wetin you go learn for Jehovah Witness meeting go really help you near Jehovah well well. This one na better reason for you to dey go Jehovah Witness meeting everytime.—Hebrews 10:24, 25.
You must study Bible before you baptize
6. You need to know everything wey dey Bible before you baptize?
6 The truth be sey Jehovah no talk sey you must know everything wey dey Bible before you baptize. The Ethiopia man no know everything wey dey inside God Word before e baptize. (Acts 8:30, 31) We go continue to dey learn about God forever. (Ecclesiastes 3:11) But if you want baptize, you need to learn and believe the main things wey Bible dey teach.—Hebrews 5:12.
7. As you dey study Bible, how e don take help you?
7 Bible tell us sey: ‘Person wey no get faith no go fit do wetin go make God happy.’ (Hebrews 11:6) So you need to get faith before you baptize. Bible tell us wetin some people for Corinth do when Jesus disciples preach to dem. E tell us sey dem believe wetin the disciples talk and dem come baptize. (Acts 18:8) Na so e still be today. As you dey study Bible, e don help you get faith for wetin God promise and e don still help you believe sey Jesus death go fit save us from sin and death.—Joshua 23:14; Acts 4:12; 2 Timothy 3:16, 17.
TELL OTHER PEOPLE WETIN YOU DON LEARN
8. Wetin go move you to dey tell other people wetin you don learn?
8 Your faith go strong more more as you dey see how wetin you dey learn for Bible take dey help you. E go still move you dey tell other people the better things wey you dey learn. (Jeremiah 20:9; 2 Corinthians 4:13) But which people you go tell?
Na your faith go make you tell other people wetin you believe
9, 10. (a) Which people you fit start to dey tell wetin you dey learn from Bible? (b) Wetin you go do if you want start to dey follow congregation go preach?
9 You fit tell people for your family, your friend, your neighbor, or people wey you dey work with, the better better things wey you dey learn. Na better thing for you to tell dem, but e good make you dey sofri talk to dem with respect. As time dey go, you fit start to dey preach with brothers and sisters for congregation. If you don ready to dey follow brothers and sisters for congregation go preach, you need to tell the person wey dey study Bible with you. And if the person wey dey study Bible with you see sey you dey do the things wey you dey learn from Bible, e go meet two elders wey go arrange to talk with you.
10 Wetin the two elders go talk to you about? Dem go like know if you really understand and believe the things wey you dey learn from Bible, whether you dey live your life as Bible talk, and know if you really want be Jehovah Witness. Get am for mind sey elders dey care for you and everybody for congregation, so no dey fear to talk to dem. (Acts 20:28; 1 Peter 5:2, 3) After dem don talk to you finish, dem go let you know if you go fit start to dey preach with brothers and sisters for congregation.
11. Why e good make you change the way you dey live your life before you follow congregation preach?
11 The elders fit tell you sey e still get some area for your life wey you need to change before you go fit start to dey follow congregation go preach. Why e good make you change the way you dey live your life? You know sey as we dey tell people about God, we dey bear im name. So, we self need to dey live our life the way Jehovah want.—1 Corinthians 6:9, 10; Galatians 5:19-21.
REPENT AND START TO DEY DO WETIN GOD LIKE
12. Why all of us need to repent?
12 Another thing dey wey you need to do before you baptize. You need to repent! Apostle Peter talk sey: ‘Repent, and change your life,’ so that God go forgive you. (Acts 3:19) But wetin e mean to repent? E mean sey the bad thing wey you do pain you well well. For example, if you dey put hand for sex wey no clean for God eye before, you need to repent. And even if you don dey try to do wetin good all your life, you still need to repent because all of us dey sin. So we need to dey beg God sey make e forgive us.—Romans 3:23; 5:1.
13. Wetin e mean to ‘change your life’?
13 No be only to let the bad thing wey you don do pain you. Apostle Peter still talk sey you need to ‘change your life.’ This one mean sey you go comot hand from all the bad things wey you dey do before, and start to do good things. For example, just think am sey you dey travel go where you never go before. And you don go far before you know sey you don miss road. Wetin you go do? You go need to stop, and turn back go follow the correct road wey go carry you go where you dey go. Na so e still be as you dey study Bible. You fit see some things wey you dey do, wey you need to stop. Make up your mind to comot hand from dem, and begin do wetin good for God eye.
PROMISE JEHOVAH SEY YOU GO SERVE AM
You don promise Jehovah sey you want serve am?
14. Wetin e mean to promise Jehovah sey you go serve am?
14 Another thing wey you need to do before you baptize na to promise Jehovah sey you go serve am. But wetin this one mean? E mean sey you go pray to Jehovah and tell am sey you don promise to serve only am. And you go dey put wetin e want as the number one thing for your life.—Deuteronomy 6:15.
15, 16. Wetin go move person to promise Jehovah sey e want serve am?
15 To promise Jehovah sey you go serve only am, just be like when you promise person wey you love sey you no go ever leave am. For example, think of man and woman wey want know each other to see if dem fit marry. As the man dey know the kind person wey the woman be, the more e go dey love am. The man come make up im mind to marry am, even though e know sey marriage na serious matter. But why the man make up im mind to marry am? Na because sey e love am.
16 The more you dey learn about Jehovah, the more you go love am, and the more e go dey your mind to do everything wey you fit do to serve am. Na this one go make you pray to am and promise am sey you want serve am. Bible show sey anybody wey want follow Jesus must know sey no be im get imself again. (Mark 8:34) Wetin that one mean? E mean sey you must put wetin God want as the number one thing for your life. Wetin Jehovah want dey important pass wetin you want, or wetin you go like do for yourself.—Read 1 Peter 4:2.
COMOT FEAR FOR YOUR MIND
17. Why some people no want promise Jehovah sey dem go serve am?
17 Some people no want promise Jehovah sey dem go serve am. Dem dey fear sey if dem promise to serve Jehovah, dem fit no do wetin dem promise. Dem no want do Jehovah promise and fail. Dem fit dey think sey as dem no promise Jehovah anything, e no go hold dem for anything wey dem do.
18. Wetin go help you comot fear for your mind?
18 The love wey you get for Jehovah go help you do wetin e want, and you no go dey fear sey you no go fit do am. Because you love Jehovah, you go do everything wey you fit do to keep your promise. (Ecclesiastes 5:4; Colossians 1:10) You no go dey think sey e too hard to do wetin Jehovah want. Apostle John talk sey: ‘If we really want show sey we love God, we go do everything wey e talk; and the truth be sey, wetin e want make we do no too hard.’—1 John 5:3.
19. Why you no suppose dey fear to promise Jehovah sey you want serve am?
19 Even though sey sin dey your body, you fit promise Jehovah sey you want serve am. Jehovah no dey tell us sey make we do wetin pass our power. (Psalm 103:14) E go help you do the correct thing. (Isaiah 41:10) Trust Jehovah with all your mind and ‘e go make your way smooth.’—Proverbs 3:5, 6.
SHOW PEOPLE SEY YOU DON PROMISE JEHOVAH TO SERVE AM
20. Wetin you go do after you don promise Jehovah to serve am?
20 You think sey you don ready to give Jehovah your life and promise am sey you go serve am? If you don do this one, e mean sey you don ready to baptize.
21, 22. How you go take show people sey you don promise Jehovah to serve am?
21 Tell the coordinator for your congregation sey you don promise Jehovah to serve am and you go like to baptize. The coordinator go arrange for some elders to follow you talk about some of the main things wey you suppose know for Bible before you baptize. If dem really see sey you don ready, dem go tell you sey you fit baptize for the next assembly or convention. For there, you go listen to talk wey go help you know wetin e mean to baptize. The person wey go give the talk go ask the people wey want baptize two simple question. When you answer the two question, e go show people sey you don promise Jehovah to serve am.—Romans 10:10.
22 You go come baptize. All your body go enter inside water when you dey baptize. When you baptize, everybody go come know sey you don give Jehovah your life and sey you don be Jehovah Witness.
WETIN YOUR BAPTISM MEAN
23. Wetin e mean to baptize in the name of the Father, the Son and the holy spirit?
23 Jesus talk sey im disciples go baptize in the name of the Father, the Son and the holy spirit. (Read Matthew 28:19.) Wetin that one mean? E mean sey you go know Jehovah, and im position as the Person wey high pass. You go know the work wey Jesus dey do to make wetin God talk happen. And you go know how God dey use im holy spirit do wetin e want.—Psalm 83:18; Matthew 28:18; Galatians 5:22, 23; 2 Peter 1:21.
When you baptize, you dey show sey you want do wetin God want
24, 25. (a) Wetin baptism mean? (b) Wetin the next chapter go talk about?
24 Baptism no be wetin person take dey play at all. As you dey enter inside water, e mean sey you don change the way you dey live your life. And as you dey come out, e mean sey you dey start new life to do wetin God want. This one mean sey na only Jehovah you go dey serve. Get am for mind sey you no give your life to any work, human being, or organization. Na only Jehovah you give am, and na only am you promise to serve.
25 If you give Jehovah your life and promise to serve am, e go help you be Jehovah tight friend. (Psalm 25:14) But this one no mean sey if person don baptize e don save be that. Apostle Paul talk for Bible sey: ‘Make una continue to dey fear God, and dey do things wey go save una.’ (Philippians 2:12) Baptism na just the beginning. But wetin go help you hold Jehovah tight? The last chapter for this book go answer the question.