CHAPTER NINETEEN
No Comot for Jehovah Side
1, 2. Who go fit protect us?
JUST think am sey as you dey waka for road one day, heavy breeze dey blow, everywhere come dark, lightning dey strike and thunder dey sound. Heavy rain come start to fall. You come dey find where you go hide. When you see better place to hide, your mind go come down, no be so?
2 Na so things be for us for this world. Things dey bad everyday. This one fit make you dey ask yourself sey: ‘Who go protect me?’ The person wey write Psalm 91 talk sey: ‘I go tell Jehovah sey: Na you be my God wey I trust, na you dey cover me, and na you dey protect me.’ (Psalm 91:2) Na true! Even now, Jehovah fit help us when wahala dey, and e don give us hope sey our tomorrow go better.
3. Wetin we go do if we want make Jehovah dey protect us?
3 How Jehovah take dey protect us? E go fit help us handle the problem wey we get, and e get power pass anybody wey go like cause wahala for us. Even though sey bad thing happen to us now, we know sey Jehovah go make things better for front. Bible tell us sey make we ‘no comot for God love.’ (Jude 21) If we no comot from Jehovah side, e go help us when wahala come. But wetin go help us make we no comot from Jehovah side?
SHOW GOD SEY YOU LOVE AM
4, 5. How Jehovah don take show sey e really love us?
4 If we want really stay for Jehovah side, we need to understand how Jehovah love us reach. Just think about all the things wey Jehovah don do for us. E make this earth fine for us, e make fine fine animal and plant. E give us better better food and clean water wey we go dey drink. Jehovah don use Bible tell us im name and the better better character wey e get. The best thing wey Jehovah don do for us na to send Jesus Christ come this earth to die for us. (John 3:16) And as Jesus die for us, we get hope sey our tomorrow go better.
5 Jehovah don arrange im Kingdom for heaven, and na Jesus Christ be the King for the Kingdom. The Kingdom go comot all the suffer suffer wey dey this world and turn this earth to paradise. For paradise, peace go dey and everybody go dey happy. (Psalm 37:29) Jehovah dey teach us the best way to live our life now. This one show sey e love us. E still want make we dey pray to am and e ready to answer our prayer. Everything wey Jehovah don do for us show sey e really love us.
6. As you know sey Jehovah love you, wetin you go do?
6 As you know sey Jehovah love you, wetin you go do? Show am sey you value everything wey e don do for you. But the thing be sey, many people no dey show sey dem value wetin Jehovah don do for dem. This kind thing happen when Jesus dey this earth. Jesus heal ten people wey get leprosy, but na only one for inside come thank am. (Luke 17:12-17) Make we be like the man wey come back to thank Jesus. So make we dey always thank Jehovah for wetin e don do for us.
7. How we suppose love Jehovah reach?
7 We need to dey show sey we love Jehovah. Jesus tell im disciples sey make dem use all their heart, all their life, and all their sense take love Jehovah. (Read Matthew 22:37.) But wetin this one mean?
8, 9. Wetin we go do to show Jehovah sey we love am?
8 To love Jehovah no be for mouth. If we use our heart, our life, and our sense love Jehovah, we go dey show am for the things wey we dey do. (Matthew 7:16-20) Bible teach us sey if we really love God, we go do everything wey e tell us. This one hard? No, because everything wey Jehovah want make we do no hard at all.—Read 1 John 5:3.
9 When we do wetin Jehovah sey make we do, we go happy and enjoy better life. (Isaiah 48:17, 18) But wetin go help us make we stay for Jehovah side? Make we see am.
CONTINUE TO DEY NEAR JEHOVAH
10. Why e good make you continue to learn about Jehovah?
10 How you take be Jehovah friend? As you dey study Bible, you come dey know Jehovah more more. Na so you take be im friend. As you and Jehovah don be friend now, you need to dey do things wey go make una continue to be friend. Just the way fire need firewood, na so you go continue to dey learn about Jehovah, so that your love for am no go die.—Proverbs 2:1-5.
Just the way fire need firewood, na so you need to dey do wetin go make your love for Jehovah no die
11. How the things wey you dey learn for Bible go make you feel?
11 As you continue to study Bible, the things wey you go learn go really touch your mind. See how two of Jesus disciple feel when Jesus dey explain wetin Bible sey go happen. Dem talk sey: ‘You no see sey wetin e talk really touch our mind, as e dey explain to us for road wetin Bible talk?’—Luke 24:32.
12, 13. (a) Wetin fit happen to the love wey we get for God? (b) Wetin we go do make our love for Jehovah no die?
12 Wetin Jesus tell the two disciple touch dem for mind. This kind thing fit don happen to you when you start to dey understand wetin you dey learn for Bible. This one help you know Jehovah and love am. Make you no let this love die.—Matthew 24:12.
13 As you don become God friend, you need to work hard so that una friendship go strong. You need to continue to dey learn about Jehovah and Jesus. Dey think about wetin you dey learn about dem, and how you go take do wetin you learn. (John 17:3) When you dey read or study Bible, ask yourself: ‘Wetin this place teach me about Jehovah? Why e good make I use all my heart, and all my life love Jehovah?’—1 Timothy 4:15.
14. How prayer take dey make the love wey we get for Jehovah strong?
14 If you get better friend and you and am dey talk everytime, e go make una tight well well. Na so e still be, when we dey pray to Jehovah everytime. This one go make our love for am strong more more. (Read 1 Thessalonians 5:17.) Prayer na better gift wey Jehovah don give us. So e good make we dey pray to am from our mind. (Psalm 62:8) E no good to dey cram prayer, but make our prayer dey come from our mind. True true, if we dey study Bible and dey pray from our mind, we go dey love Jehovah more more.
TALK TO OTHER PEOPLE ABOUT JEHOVAH
15, 16. Wetin suppose move you to go preach?
15 Another thing wey go help us stay for Jehovah side na to dey tell other people wetin we believe. Na favor Jehovah do us as e allow us to dey tell people about am. (Luke 1:74) Na the work wey Jesus give all correct Christians. So make all of us dey preach the good news about God Kingdom. You don start to dey preach?—Matthew 24:14; 28:19, 20.
16 Apostle Paul value the preaching work well well. (2 Corinthians 4:7) The number one work wey we suppose do na to dey preach to people about Jehovah and the things wey e want do. Preaching na one way to serve Jehovah, and e value wetin we do for am. (Hebrews 6:10) If you preach to people, you and the people wey listen to you go gain. Because you and dem go come near God, and get life wey no go end. (Read 1 Corinthians 15:58.) No other work go ever fit make us happy like this!
17. Why we no suppose take preaching play?
17 Make we no use preaching play because time no dey again. Make we ‘dey preach the word’ and make we ‘no waste time.’ (2 Timothy 4:2) People need to hear about God Kingdom. Bible even talk sey: ‘Jehovah great day don near! E don near, and e dey come with full speed!’ The end dey come, e no go ‘waste time.’ (Zephaniah 1:14; Habakkuk 2:3) Na true! Jehovah go soon destroy this world wey Satan dey control. But before e happen, people need to hear God message so that dem fit choose to serve Jehovah.
18. Why e good make we dey join God people dey serve am?
18 Jehovah want make we follow im people serve am. Bible talk sey: ‘And make we dey think about how we go take help each other so that we go show love and do better work. Make we no dey miss our meeting as some people dey do, but make we dey encourage ourself, especially as the day don dey near.’ (Hebrews 10:24, 25) Make we try well well so that we no go dey miss any meeting. For meeting, we dey get the chance to dey encourage ourself and dey make our faith strong.
19. Wetin go help us love brothers and sisters?
19 If you go meeting, you go see better friends wey go help you serve Jehovah well. For there, you go see many brothers and sisters. Dem dey try their best to serve Jehovah well like you. Dem still dey make mistake like you. So if dem make mistake, make you ready to forgive dem. (Read Colossians 3:13.) Make you dey always put eye for the better character wey our brothers and sisters get. This one go help you love dem and help you near Jehovah more more.
THE REAL LIFE
20, 21. Wetin be the real life?
20 Jehovah want make all im friend get the best life. Bible tell us sey the kind life wey we go live for paradise go better pass this one wey we dey live today, by far!
Jehovah want make you enjoy ‘the real life.’ You go like enjoy am?
21 For paradise, we go get life wey no go end. We no go just live for 70 or 80 years come die. We no go dey sick again. Peace go dey everywhere. Everybody go dey happy. Paradise go fine no be small. Na this one Bible call ‘the real life.’ Jehovah don promise sey e go give us this real life. But we need to do everything wey we fit do to fit get that real life.—1 Timothy 6:12, 19.
22. (a) Wetin we go do if we want enjoy this real life? (b) Why we fit talk sey the real life na gift?
22 Wetin we go do if we want enjoy this real life? We must ‘do wetin good,’ and ‘dey do better work.’ (1 Timothy 6:18) This one mean sey we need to dey do wetin we dey learn from Bible. But make we no think sey life wey no go end suppose reach our hand because we work for am. Na gift wey Jehovah go give us. God promise sey e go give life wey no go end to people wey serve am well. This na one example of im favor. (Romans 5:15) E really dey Jehovah mind to give us this better gift wey be the real life!
23. Why e good make we dey serve God the way e want?
23 Ask yourself: ‘I dey serve God the way e want? If you see sey you need to change, no waste time, change! When we trust Jehovah, and dey do everything wey we fit do to obey am, e go protect us. Jehovah go protect all the people wey hold am tight for this last days. Jehovah go still make sure sey we stay for paradise forever, as e don promise. Na true, you fit get that real life if you dey serve God the way e want now!