Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • lfb lesson 4 p. 16-p. 17 par. 2
  • E Vex Kill Im Brother

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • E Vex Kill Im Brother
  • Lesson Wey You Fit Learn From Bible
Lesson Wey You Fit Learn From Bible
lfb lesson 4 p. 16-p. 17 par. 2
Cain dey vex as Abel dey sacrifice to Jehovah

LESSON 4

E Vex Kill Im Brother

After Adam and Eve comot for the garden of Eden, dem come born many pikin. Their first pikin name na Cain and na farmer, their second pikin name na Abel, e dey take care of sheep.

One day Cain and Abel give Jehovah sacrifice. You know wetin sacrifice mean? Sacrifice na special gift. Jehovah like the one wey Abel give but e no like the one wey Cain give. That one come make Cain vex well well. Jehovah warn Cain sey the way e dey vex go make am do bad thing. But Cain no hear word.

Instead wey Cain go follow wetin God talk, e tell Abel sey: ‘Come make we go farm.’ When only their two dey there, e use something nack Abel head. Abel come die! Wetin you think sey Jehovah go do Cain? Jehovah punish Cain, e tell am sey make e go far from im family. E no go allow Cain come back again.

Cain dey go meet Abel for farm

Wetin we learn from wetin happen? We learn sey we fit start to dey vex if things no happen the way we think sey e suppose happen. If we see sey we dey vex for our mind or another person come tell us because e see sey we dey vex, make we quick quick control ourself before we go do bad thing.

As e be sey Abel do wetin Jehovah like, Jehovah go always remember am. God go bring Abel come back to life when e make this earth paradise.

‘First go settle with am, before you go come give God the thing.’​—Matthew 5:24

Question: Who be Adam and Eve first two pikin? Wetin make Cain kill im brother?

Genesis 4:1-12; Hebrews 11:4; 1 John 3:11, 12

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share