Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • lfb lesson 18 p. 48-p. 49 par. 4
  • The Bush Wey Fire Dey

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • The Bush Wey Fire Dey
  • Lesson Wey You Fit Learn From Bible
Lesson Wey You Fit Learn From Bible
lfb lesson 18 p. 48-p. 49 par. 4
Moses dey the bush wey fire dey

LESSON 18

The Bush Wey Fire Dey

Moses stay Midian for 40 years. E marry and e get pikin. One day, as e dey take care of sheep near the mountain wey dey Sinai, e see something wey e never see for im life before. E see bush wey fire dey, but the bush no dey burn. As Moses dey near am to see why, e hear one voice from the bush sey: ‘Moses! No near this place. Pull your sandals because na holy place you dey stand so!’ Na Jehovah use angel talk to am.

Fear catch Moses, na im e cover im face. The voice sey: ‘I don see as Israel people dey suffer. I go save dem from Egypt people hand come put dem for better land. Na you go carry dem comot from Egypt.’ You no think sey that one go surprise Moses?

Moses sey: ‘Wetin I go talk if dem ask me sey, who send me?’ God come tell am sey: ‘Tell dem sey na Jehovah, the God wey Abraham, Isaac, and Jacob serve na im send you.’ Moses come sey: ‘What if the people no listen to me?’ Jehovah come show Moses sey e go help am. E tell am sey make e throwey im stick for ground. Na im the stick turn to snake! As Moses hold the snake tail e turn to stick back. Jehovah come tell am sey: ‘If you do this miracle, e go show sey na me send you.’

Moses come sey: ‘I know sabi talk well.’ But Jehovah promise am sey: ‘I go tell you wetin you go talk, and I go send your brother Aaron make e help you.’ When Moses see am sey Jehovah dey with am, e carry im wife and pikin and start to dey go Egypt.

‘Make una no worry about wetin una go talk or how una go talk am. God go give una wetin una go talk that time.’​—Matthew 10:19

Question: Wetin Moses see as e dey take care of im sheep? Wetin Jehovah want make Moses do?

Exodus 3:1–4:20; Acts 7:30-36

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share