Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • lfb lesson 19 p. 50-p. 51 par. 2
  • The First Three Things Wey God Take Punish Egypt

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • The First Three Things Wey God Take Punish Egypt
  • Lesson Wey You Fit Learn From Bible
  • Similar Material
  • The Next Six Things Wey God Take Punish Egypt
    Lesson Wey You Fit Learn From Bible
  • Na Jehovah Moses Worship
    Lesson Wey You Fit Learn From Bible
  • The Last Thing Wey God Take Punish Egypt
    Lesson Wey You Fit Learn From Bible
Lesson Wey You Fit Learn From Bible
lfb lesson 19 p. 50-p. 51 par. 2
Moses and Aaron stand for Pharaoh front

LESSON 19

The First Three Things Wey God Take Punish Egypt

Egypt people force Israel people work as slave. Jehovah tell Moses and Aaron sey make dem tell Pharaoh sey: ‘Let my people go make dem go worship me for desert.’ Pharaoh make mouth sey make Jehovah go sitdown, e sey: ‘Israel people no dey go anywhere.’ Pharaoh come force dem to dey work pass before. Jehovah go show Pharaoh pepper! You know how e take do am? E punish Egypt people ten times. Jehovah tell Moses sey: ‘Pharaoh no dey listen to me. Tomorrow morning, e go dey river Nile. Go meet am and tell am sey as e get stronghead so, all the water for river Nile go turn to blood.’ Moses obey, so e go meet Pharaoh. Pharaoh dey look Aaron as e nack the Nile river with im stick, na im the water turn to blood. The river come dey smell, fish come dey die for inside, and people no come see better water drink for there again. But Pharaoh no still let dem go.

After seven days, Jehovah tell Moses make e go meet Pharaoh again and tell am sey: ‘If you no let my people go, frog go full Egypt.’ But Pharaoh no still let dem go. Na im Aaron raise im stick and frog start to full everywhere. Dem see frog for their house, their bed and their plate. Frog full everywhere! Pharaoh come sey make Moses beg Jehovah make e stop am. E promise sey e go let Israel people go. So Jehovah stop am, na im Egypt people start to dey gather all the frog wey don die. Everywhere come dey smell. But Pharaoh no still let dem go.

Jehovah come tell Moses sey: ‘Make Aaron nack ground with im stick and dust go turn to small small fly wey dey bite.’ Na once, fly wey dey bite full everywhere. Some of Pharaoh people come dey tell am sey: ‘Na God dey punish us so.’ But Pharaoh no still let dem go.

Three things wey God take punish Egypt from the ten things na: blood full river Nile , frog, and fly wey dey bite

‘I go make dem know my power and my force, and dem go know sey my name na Jehovah.’​—Jeremiah 16:21

Question: Wetin be the first three things wey God take punish Egypt? Why Jehovah use am punish dem?

Exodus 5:1-18; 7:8–8:19; Nehemiah 9:9, 10

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share