Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • lfb lesson 45 p. 110-p. 111 par. 1
  • Jehovah Divide the Kingdom

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Jehovah Divide the Kingdom
  • Lesson Wey You Fit Learn From Bible
  • Similar Material
  • Rehoboam for Make God E Tight Friend
    Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2018
Lesson Wey You Fit Learn From Bible
lfb lesson 45 p. 110-p. 111 par. 1
Ahijah tear im cloth into 12 part for front of Jeroboam

LESSON 45

Jehovah Divide the Kingdom

When Solomon dey worship Jehovah, Israel people no get wahala. But e come marry many many women wey dey serve juju. Small small, e come start to dey serve juju. Jehovah come dey vex for am, na im e tell am sey: ‘I go comot Israel from your family and share am into two. I go give one of your servant the part wey big pass, but your family go rule the small part.’

Jehovah still make wetin e want do dey clear for another way. One of Solomon servant wey dem dey call Jeroboam dey road when e meet prophet Ahijah. The prophet tear im cloth into 12 part and tell Jeroboam sey: ‘Jehovah go comot Israel from Solomon family and divide am into two. Take ten part because na you go be the king of the ten tribe.’ When Solomon hear am, e want kill Jeroboam, but Jeroboam run go Egypt. After some years, Solomon come die. Rehoboam wey be im pikin come be the next king. Jeroboam come reason am sey time don reach when e go go back to Israel.

Many Israel people dey sacrifice to the two small cow wey Jeroboam make

The elders wey dey Israel tell Rehoboam sey: ‘If you dey do the people well, dem go support you.’ But Rehoboam young friends tell am sey: ‘No pity dem at all at all! Make dem work well well.’ Rehoboam listen to wetin e friends tell am. E come dey suffer people, this one come make the people tire for am. So people for the ten tribe come leave am. Dem come make Jeroboam king for the ten tribe, the kingdom come be Israel kingdom. The two tribe wey remain come be Judah kingdom. This two tribe no leave Rehoboam. Na so the 12 tribe wey dey Israel take divide.

Jeroboam no want make e people dey go worship for Jerusalem wey dey Rehoboam kingdom. You know why? Jeroboam dey fear sey im people go dey support Rehoboam. E come mold two small cow and tell im people sey: ‘Jerusalem too far. Make una dey worship for here.’ The people come start to dey worship the two small cow and forget Jehovah again.

‘No join yourself with people wey no dey serve Jehovah like sey una be the same. Na which business good and bad get? Or wetin person wey dey serve God get with person wey no dey serve God?’​—2 Corinthians 6:14, 15

Question: Wetin make Jehovah divide Israel kingdom? Which bad thing King Rehoboam and King Jeroboam do?

1 Kings 11:1-13, 26-43; 12:1-33

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share