Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • lfb lesson 83 p. 194-p. 195 par. 1
  • Jesus Give Many People Food Chop

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Jesus Give Many People Food Chop
  • Lesson Wey You Fit Learn From Bible
  • Similar Material
  • The Last Passover
    Lesson Wey You Fit Learn From Bible
  • Jesus Waka for Top of Water
    Lesson Wey You Fit Learn From Bible
Lesson Wey You Fit Learn From Bible
lfb lesson 83 p. 194-p. 195 par. 1
The apostles dey share food give many people

LESSON 83

Jesus Give Many People Food Chop

Before the Passover wey dem do for the year 32 C.E., the apostle come back from where dem go preach. Dem tire well well, so dem follow Jesus enter one boat wey go carry dem go Bethsaida, make dem for rest. But when the boat don near dry land, Jesus see sey many people follow dem come there. Na true sey Jesus want dey with only im apostles, but e still welcome dem well. E cure sick people and e start to dey teach dem. Jesus use the whole day teach dem about God Kingdom. When evening reach, im disciples come tell am sey: ‘The people go don dey hungry now. Let dem go, make dem go find food chop.’

One boy dey give Jesus one basket wey bread and fish dey

Jesus tell dem sey: ‘Dem no need to comot. Make una give dem food chop for here.’ The apostles ask am sey: ‘You want make we go buy bread for dem?’ Philip wey be one of the apostle tell am sey: ‘Even if na we get money pass, we no go fit buy bread wey go belleful this people.’

Jesus ask dem sey: ‘How the food wey we get many reach?’ Andrew answer am sey: ‘We get five bread and two small fish. E no go reach at all.’ Jesus tell dem sey: ‘Make una give me the bread and fish.’ E tell the people sey make dem sitdown for grass, and e share dem for many group. Some group na 50 people and other group na 100 people. Jesus carry the five bread and two fish, e come look heaven as e dey pray. As e pray finish, e give the apostles the food make dem share am. The 5,000 men, the women and the children chop belleful. The apostles come carry the food wey remain make e for no waste. Na 12 basket of food come remain! That one na big miracle, no be so?

The people happy well well sotey dem want make Jesus their king. But Jesus know sey time never reach when e go be king. So e tell the people sey make dem go and e tell im apostles sey make dem go the other side for Galilee. Dem come enter boat, but only Jesus come go mountain. You know why? Na because e no want make anybody disturb am as e want pray to im Father. Even though sey Jesus no too get time, e dey always arrange time to pray.

‘No work for the food wey go fit spoil, but work for the food wey go dey forever, wey the Son of man go give una.’​—John 6:27

Question: How Jesus take show sey e dey care for people? Wetin that one teach you about Jehovah?

Matthew 14:14-22; Luke 9:10-17; John 6:1-15

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share