Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • lfb lesson 96 p. 224-p. 225 par. 2
  • Jesus Choose Saul

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Jesus Choose Saul
  • Lesson Wey You Fit Learn From Bible
  • Similar Material
  • David and Saul
    Lesson Wey You Fit Learn From Bible
  • The First king Wey Rule Israel
    Lesson Wey You Fit Learn From Bible
Lesson Wey You Fit Learn From Bible
lfb lesson 96 p. 224-p. 225 par. 2
Light dey shine for Saul face

LESSON 96

Jesus Choose Saul

Saul na Rome person wey dem born for Tarsus. Im na Pharisee and e know Jew people Law well well. E hate Christian no be small. E dey drag Christian comot for their house put dem for prison. E even dey among people wey sey make dem stone Stephen die.

But the Christian wey dey Jerusalem wey e dey arrest no reach am. Saul tell the high priest sey make dem send am go Damascus, make e go arrest Christian wey dey there. As Saul dey near Damascus, e see sey light shine for im face. E come fall for ground. E hear person ask am sey: ‘Saul, why you dey give me wahala?’ Saul ask am sey: ‘Who you be?’ The person answer am sey: ‘I be Jesus. Enter Damascus, you go know wetin I want make you do.’ Saul no come dey see again, na another person come hold e hand go Damascus.

One of the Christian wey dey serve Jehovah well for Damascus na Ananias. Jesus tell am for dream sey: ‘Go Judas house for the road wey dem dey call Straight, go find Saul.’ Ananias sey: ‘My Lord, I know that man o! E dey put your disciples for prison!’ But Jesus tell am sey: ‘Go meet am, I don choose Saul to preach the good news for many country.’

Saul eye blind after the light shine for im face

Na im Ananias go find Saul and tell am sey: ‘Saul, my brother, Jesus sey make I come open your eye.’ Na once Saul come dey see. Saul come learn about Jesus and e come be Jesus disciple. As Saul baptize as Christian, e come join other Christian dey preach for where dem dey worship. You no think sey Jew people go surprise well well to see Saul dey preach about Jesus? Dem talk sey: ‘No be the man wey dey suffer Jesus disciples be this?’

For three years, Saul preach to Damascus people. Jew people come hate am. Dem come even dey plan to kill am. When the other disciples hear am, dem show Saul road make e for run. Dem put am for basket come use am pass hole wey dey Damascus fence.

When Saul go back to Jerusalem, e try go join Christian wey dey there. But dem dey fear am. One of the disciples wey dem dey call Barnabas come pity for Saul, e come carry am go meet the apostles. E tell the apostles sey Saul don change true true. Saul come join the congregation for Jerusalem dey preach the good news. Later, Saul name come be Paul.

‘Jesus Christ come this world come save sinners. And I be number one.’​—Acts 5:29

Question: Wetin make Christian for Jerusalem dey fear Saul? Wetin make Saul change?

Acts 7:54–8:3; 9:1-28; 13:9; 21:40–22:15; Romans 1:1; Galatians 1:11-18

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share