Wetin Dey Part 9
This part talk about young people, prophet and king wey show sey dem get strong faith for Jehovah. For Syria, one young girl wey come from Israel believe sey Jehovah prophet go make Naaman well. Prophet Elisha use all im mind believe sey Jehovah go save am from people wey be im enemy. Jehoiada wey be high priest put im life for danger to save Jehoash from im wicked grand mama Athaliah. King Hezekiah believe sey Jehovah go save Jerusalem, and e no let Assyria people make am leave Jehovah. King Josiah comot juju worship from Israel, build the temple again and help people to serve Jehovah again.